President Beji Essebsi dey hospital, as Tunisia dey shake ontop twin bomb blasts

President Beji Essebsi enta office for December 2014

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Oga Essebsi na currently di world oldest sitting president.

Official sources inside Tunisia say dem don cari President Beji Essebsi go hospital.

Di presidential office say di 92-year-old bin suffer wetin dem consider as "severe health crisis".

President Beji Essebsi enta office for December 2014. Oga Essebsi na currently di world oldest sitting president.

Tunisian Prime Minister Youssef Chahed say im be visit di president for hospital, and beg everyone to stop to dey spreadi "fake news" about Essebsi condition afta some media reports say im don die.

Di president dey receive "all di necessary attention im needs", Oga Chahed write for one Facebook post (inside Arabic language).

Tunisia dey shake ontop twin bomb blasts

Police dey close off bomb sites

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Police dey close off bomb sites

One police officer don die and plenti more injure for two kill you-kill mysef bomb attacks on Thursday for Tunisia capital of Tunis.

Di interior ministry confam di two attacks say one of di suicide bomb explode for front of police patrol and di second one happun for police station.

Dem say two police officers and three civilians wounjure for di first attack while four pipo wounjore for di second one.

But nobodi don comot to claim say na dem do dis attacks. Police don cover di areas wey di bomb attacks bin happun.

Man dey hold im small pikin well for di site of di second blast

Wia dis foto come from, Getty Images

Attacks like dis bin happun for last year for di capital, Tunis major road, wey dem dey call Avenue Habib Bouurguiba wey injure nine pipo.

Andd ofr 2015, dem bin attack one museum for di capital wey kill 22 pipo.

Dat time, militants wey connect to di so called Islamic State tok say na dem do di attacks.