Minie Mouse don finally get Hollywood Star

Wia dis foto come from, Getty Images
Popular Disney cartoon character Minie Mouse don get star for Hollywood Walk of Fame forty years after Mickey Mouse get im own.
Dem put Minie Mouse star for side of where Mickey Mouse own dey.
Di cartoon character tell Mickey Mouse say she happy well-well as im dey there to see di honour wey dem give her. "Dis na di best day of my life", Minie Mouse talk.

Wia dis foto come from, Getty Images
American pop star Katy Perry wey also wear red and white polka-dot dress like Minie Mouse show face for di event.
Na for 1978 dem bin give Mickey Mouse im own star for Hollywood Walk of Fame.
Skip Di one wey oda users dey read well well and continue reading
Di one wey oda users dey read well well
End of Di one wey oda users dey read well well










