Oprah for US President: Cartoon fit show di future

Wia dis foto come from, Sony Pictures
Many times people dey watch cartoon make dem laugh as e dey sweet dem for belle.
But as e be so, if you dey follow wetin dem dey talk inside e go be like say some things wey dem dey show be things wey go happen for future.
Why e be like dat? Dem get juju abi dem don already play fast forward for di CD wey everybodi dey watch as world matter dey go?
After Oprah Winfrey do speech wen she collect award for Golden Globes wey happen for US last Sunday, 8 January 2018, na im people dey talk say she go be di next US president.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
But di cartoon Boondocks don already carry dat tori for 2006.
Boondocks na black cartoon wey dey talk plenty matter wey dey affect black people for America.
Whether you dey see am or you dey close eye dey watch your television, e get some things wey cartoon don show before-before and now, di things don dey happen.
Make we check some of dis kain things.
End of Di one wey oda users dey read well well
President Donald Trump

Wia dis foto come from, 20th Century FOX
For 2000, di Simpsons cartoon show Donald Trump as President of the United States.
Dat time wen people watch am, e be like joke.
After Trump, dem come show say na woman come win election to be dia new president.
Sophia
Machine wey dey run things for person be another thing wey cartoon don show go happen.
Di cartoon 'Di Jetsons' wey run for 1960s show one machine, 'Rosie di Robot Maid' wey dey clean di family house.

Wia dis foto come from, ATRICIA DE MELO MOREIRA/AFP/Getty Images
And now, e be like say no be lie.
Different companies don arrange robot wey fit do different things, from dog to even di one wey resemble human being and dey talk sef.
Flat TV screen
Di same 'Di Jetsons' cartoon also show flat TV for di first time.

Wia dis foto come from, Warner Bros. Entertainment
Now flat screen TV dey everywhere.










