Big Brother Naija S7 latest eviction show: Ilebaye and Khalid chop eviction from di Big Brother Naija house

Wia dis foto come from, BBNAIJA
Ilebaye Odiniya and Khalid don end dia journey for di Big Brother House.
Dem bin di latest housemates to dey evicted from di Big Brother Naija Level Up Season 7 reality show.
Dia eviction dey come afor di third week since di reality show start.
Na five housemates bin dey up for eviction, Bryann, Groovy, Ilebaye, Khalid and Phyna.
Phyna dey saved, while Bryann and Groovy also get enough votes to remain for di house.
Remember say for di third week, Head of House nominate five level 2 Housemates for possible eviction dis Sunday.
For di previous week, Beauty dey disqualified from di show, While Christy O and Cyph dey evicted from di show.
Di third housemates to dey evicted - Ilebaye

Wia dis foto come from, BBNAIJA
Ilebaye dey plan to focus on things she love to do afta she comot from di house.
End of Di one wey oda users dey read well well
During her time for di house, she bring all di Gen Z drama and vibes.
Di 21-year old na criminology and security studies graduate and entrepreneur.
She like to swim, party and she dey reason hersef as a controversial and adventurous go-getter.
She say she no believe in love but maybe one day she go find reason to believe in love.
23 housemates still dey for di Big Brother Naija house dey contest for di N100m grand prize.
Di fourth housemate - Khalid

Wia dis foto come from, BBNAIJA
Im full name na Ismail Rukuba Ahalu. Di 22 year old na freelance graphic designer and muralist. E come from Plateau state and dey like try new things. E like archery, skateboarding, basketball and get interest for mythology.
E say now wen e don comot from di house, im plan na to make plenty money.
Na 23 housemates remain for di Big Brother Naija season 7 reality show wey dey hustle for di N100m grand prize.
Na only one pesin go win di ultimate prize and di pesin go be one wey get di highest votes to remain for di house.
Who be Big Brother Naija winners so far?
Di show don do six seasons and don get six winners.
Katung Aduwak, Efe Ejeba, Miracle Igbokwe, Mercy Eke, Olamilekan Agbeleshe and Hazel Oyeze Onou be di winners of di previous seasons respectively.
Di show popular not only for di money and gifts di winners and participants dey enjoy, but also for di opportunities wey participants dey enjoy wen dem commot from di house.
Dis season winner walk away with ₦100 million worth of prizes, including a cash sum of ₦50 million.
Why so much noise about 'Africa biggest reality show'?
Big Brother Naija na di Nigerian Franchise of di reality show Big Brother.
Na reality show wia contestants dey live for isolated house and dey compete for a large cash prize by avoiding eviction by di viewers.
Some analysts say BBNaija na Africa biggest reality show. Na MultiChoice Nigeria dey organise am.
But di show dey draw criticisms say na big distraction for di youths and some pipo dey against am for not promoting 'morality'.
But every year since e seven season run - during di months e dey air, e dey dominate social media conversations on Twitter, Facebook, Instagram and elsewhere.
During di period e dey on, Big Brother Naija dey drive engagement and conversations for social media even as much as politics.
Di programme dey air not only for Nigeria, but for 48 oda African kontries, to an average audience of 309 million viewers according to DSTV media sales figures. With peak viewing for di beginning of di programme, some eviction shows, and di finale.












