School resumption in Lagos: Universities for Lagos go reopen on September 14

Wia dis foto come from, Twitter/Babajide Sanwo-Olu
Lagos State govnor Babajide Sanwo-Olu don announce say all tertiary institutions for di state go reopen from September 14.
For inside im briefing on di state response to covid-19, di govnor also tok say Primary and Secondary schools go "tentatively reopen by 21st of September.
Nigeria goment bin close all schools including University, Secondary and Primary schools on March 26 to stop di spread of coronavirus for di kontri.
But dem bin announce say students wey dey exit classes go return to school on August 4 so as to write dia graduate exams.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Di govnor cut parents and school administrators warning say: "di decision no dey cast in stone as e dey subject to review of ongoing modelling and di procedures wey di state ministry of health go release".
Im also tok say bars, lounge, spas, night clubs go remain closed for now.
As at August 29, Lagos State wey be di epicentre of di virus for Nigeria currently don record 18,083 confam cases of coronavirus of which out of dat number 13,636 don recover while 204 pipo don die.
According to di govnor, restaurants now dey permitted to open for "in-dining services, and dem must ensure say dem maintain 50% maximum occupancy at any point in time.
End of Di one wey oda users dey read well well











