Coronavirus lockdown update: Lagos goment don allow places of worship and social centers to reopen - See di guidelines dem suppose follow

Babajide Sanwo-Olu

Wia dis foto come from, Twitter/Babajide Sanwo-Olu

Read am in 2 mins

Lagos state goment don draw ear give leaders and owners of religious and social centres on di rules dem must to follow as di state give green light for dem to reopen.

Di state govnor, Babajide Sanwo-Olu, say all di religious and social centres must first collect clearance from di Lagos State Sport Commission (LSSC) before dem begin open dia doors to pipo from August 7, 2020.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Di Presidential Task Force on Covid-19 bin down allow di reopening of churches and mosques in di kontri but di Lagos State goment no gree allow worship centres for di state to reopen.

According to di Nigeria Centre for Disease Control (NCDC) wey be di national bodi for coronavirus for di kontri don give guidelines wey churchs and mosques must to follow if dem wan reopen. Dis guidelines, as NCDC tok, na to give additional requirement wey worship houses must do to keep pipo safe. Dis guidelines include;

• Pesin wey no wear face mask no go enter. Pipo for di worship centre and dia leaders must wear face mask.

• Pipo wey no well must not go to place of worship. Di church must to take temperature of all di pipo before dem enter.

• Hand washing tins and hand sanitizers must to dey for di entrance and every oda place.

• Pipo wey dey di worship centre must not pass 1/3 di chairs wey dey church.

• Mark must dey show two meters distance between pipo.

• No form of direct contact must happun. Pipo must no shake hands for church.

• Anytin wey go need make pipo share tins must nor happun. For example, muslims must do ablution for house.

• Dem must disinfect religious houses before and after worship.

Wetin social centres must do?

Di state govnor also give rules wey social centre must to obey too. Sanwa-Olu say pipo go fit siddon, chop for restaurants now but for dat to happun dem must obey all di health guideline to take reduce spread of coronavirus.

According to di NCDC, dis na wetin social centres must do to ensure say coronavirus no spread for dia domot.

•Dem must mark di room to show sign where pipo go siddon on stand wey go mainaint social distancing.

•Dem must provide plenty places wey pipo go fit pass to enter or go out so dat pio no go crowd for on place.

•If dem go share food, dem must create plenty places where dem go fit share food.

•Where pipo for fit wash dia hands must dey every door wey enter di room.

•Di organisers must tell di pipo wetin di importance of washing of hands, and put informate about say make dem not touch dia eyes, nose and mouth with dirty hands.

•Dem must to avoid shaking, hugging and oda physical contact.

•Pipo wey get cough or no fit breah well must stay for house.

•Pipo must cover dia mouth and nose with tissue if dem wan sneeze.

Govnor Sanwo-Olu add say make pipo no pass 50 for any gathering. As at Sunday, Augut 2, 2020,, Lagos don record 15,186 cases out of di 43,537 cases from Nigeria.