Latest update on airport resumption in Nigeria: NCAA don suspend 21 June airport reopening for di West Africa nation - Dis na why

Wia dis foto come from, NCAA
- Author, Ogechi Obidiebube
- Role, BBC News Pidgin, Lagos
- Read am in 2 mins
Di Nigerian Civil Aviation Authority (NCAA) on Thursday suspend di resumption of domestic flights wey suppose start on June 21.
NCAA say di postponement na sake of say di 21 June date no dey possible for dem to resume domestic flights for di kontri.
Dem add say dem no go approve di resumption of flights until di aviation authority confam say dem go fit restart flight operations in manner wey dey "safe, secure, organized and efficient."
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
See di guidelines wey passengers go follow wen airport open for Nigeria during di Covid-19 pandemic

Wia dis foto come from, FAAN
Passengers must wear facemask to gain access to di airport terminal building.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
- Checking of passengers temperature by di appropriate authority dem
- Airport authority don put marker for ground to guide passengers dem movement for wia dem go stand for any queue wen dem enta inside di airport
- Di counters wia airline agents go attend to passengers go get transparent barriers to protect di stakeholders.
- Afta di barrier any where passengers go, whether na screen or di departure lounge di marker for di ground go guide dia sitting arrangement, dis na to help dem know wia to sit or not.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 3
- Airport staff go guide passengers to make sure say dis rules no spoil.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 4
- At di point of boarding, airline go provide sanitizers for each passenger hands before dem enta di plane.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 5








