Third Mainland Bridge closure Lagos: See how road traffic affect pipo in history

Nigeria goment don begin partial closeu third mainland bridge by midnight Friday July 24 to do major maintenance work. Di closure go last for six months.
Na partial closing e go be, one lane for three months and den afta dem go change to di oda lane for anoda three months according to di Federal Controller of Works for Lagos, Olukayode Popoola.
Dis no be di first time wey di goment go close down di bridge sake of repair work. In recent time dem do am for 2018 and again for 2019 but e be like say dis one for 2020 go be major repair work.
Goment alsio close di bridge do maintenance work for 2002 and 2012 according to Nigeria minister of transportation Rotimi Amaechi.
Lagos State goment shut down di 3rd Mainland Bridge from midnight of Thursday 23 August to midnight of Sunday 26 August 2018 to cari out Investigative Maintenance Test.
Na 30 years ago di Nigeria goment build di Third Mainland Bridge.

Important tins to sabi about 2020 Third Mainland Bridge closure
- Di first side of Third Mainland Bridge to close na di side wey carry traffic from island come mainland.
- Work go dey happun day and night for di period although if work on di first side conclude before three months reach, dem go switch to di oda side.
- Di goment dey consider to divide one side of di bridge so that e go carry vehicles go, come (two directions)
- Lagos State dey torchlight how to make water transport work well-well during dis period
- Authorities, including military go dey ground across Lagos to control di heavy traffic
Wetin happun when dem close am For 2018
Goment also do few days closure for 2018 and 2019 to check weda di bridge still dey ok, na di report wey dem compile from 2019 check na im dem use decide to work ontop di bridge dis year.
Pipo face plenti traffic wahala wen dem close am for 2018. Plenti pipo park dia car for home and decide to use public transport. Dis make plenti passengers come boku for bus stops.
End of Di one wey oda users dey read well well

Ikorodu wey be di major alternative route witness plenti traffic jam sake of plenti pipo wey dey go from di Lagos mainland to Lagos Island.
Di situation cause plenti pipo to reach dia work place very late as dem face plenti traffic for road.
Even though goment put signs for road to show pipo alternative routes, yet plenti pipo pass wrong way and join to cause traffic.
As goment announce say dem wan close di bridge dis year, dem begin do repair work for alternative routes like Eko and Carter bridge plus Ikorodu road and odas.
Di repair work for di alternative routes make dem close some of di roads wey come cause plenti traffic for di city on Wednesday and Thursday.

Why dem close TMB at different times from 2008 - 2012
By 2006, many Lagosians wey dey use di bridge alias commuters begin fly tori up and down say di Third Mainland Bridge dey vibrate, according to wetin dem notice, say e need urgent attention. Authorities deny di tori. However, sake of all di complaints dat time, oment do remedial work on the portions of di bridge at different times, leading to partial closure of the bridge at different times between 2008 and 2012 and as at January 2013, dis work don dey completed.

Wia dis foto come from, PIUS UTOMI EKPEI
Third Mainland Bridge History
Di Third Mainland Bridge na di longest bridge in Africa until 1996 wen dem build 6th October Bridge located in Cairo, Egypt. Di bridge start from Oworonshoki wey dey linked to di Apapa-Oshodi expressway and Lagos-Ibadan expressway, and end for di Adeniji Adele Interchange on Lagos Island.
E also get link midway through di bridge wey lead to Herbert Macaulay Way, Yaba.
Na Julius Berger Nigeria PLC na im build di Third Mainland Bridge. Di phase one of di project na President Shehu Shagari cut di tape alias commission am in 1980 and and na President Ibrahim Babangida complete am in 1990.
Di length of di bright fit measure about 11.8 km long and na di longest of di three bridges wey dey connect Lagos mainland to Lagos Island.












