Third Mainland Bridge: Goment don open am again
Third Mainland Bridge, wey goment close on Friday 24 August, don open on Sunday 26 August.
Permanent Secretary for Lagos Ministry of Transportation, Dr Taiwo Salaam, tok am for statement say dem decide to open am early because engineers don finish wetin dem dey do dia.
Engineers wey follow BBC Pidgin yan tok say dis kain inspection dey normal and very important.

Wia dis foto come from, PIUS UTOMI EKPEI
Goment bin close di bridge, wey be di main way wey Lagosians dey follow enta mainland and Island, as dem wan do maintenance test and na Monday early mor-mor dem bin plan to allow motor to start to dey use again before.
Na 30 years ago di Nigeria goment build di bridge and as dem close am so, goment arrange oda areas wey pipo go dey follow.

Mr Salaam thank drivers and pipo wey dey live for Lagos for dia patience wen dem close di bridge.










