Third Mainland Bridge: "We dey check weda di joints don expire"
Lagos state and Nigeria goment put hand togeda close Third Mainland Bridge. Di bridge na di main one wey connect mainland wit Island and na im pipo dey use pass.
Goment say dem wan torchlight di bridge small to see di tins and area wey don expire to know how dem go repair am.
Engineers wey follow BBC Pidgin yan tok say dis kain inspection dey normal and very important.
