Third Mainland Bridge closure: See wetin pipo dey face for road

Many Lagosians way get waka to do dey sweat for road as goment close Third Mainland Bridge to do inspection.

Goment try as dem put sign evri wia dey tell pipo di oda wey dem fit follow
Wetin we call dis foto, Lagos state and Nigeria goment put hand togeda tok say dem go close Third Mainland Bridge. Di bridge na di main one wey connect mainland wit Island and na im pipo dey use pass. Goment say dem wan torchlight di bridge small before dem decide how dem go repair anytin wey dem suppose repair.
See oda road to follow wen di bridge close:
Wetin we call dis foto, But Goment do well as dem put sign evri wia dey tell pipo di oda wey dem fit follow.
Federal goment for Nigeria don close Third Mainland bridge.
Wetin we call dis foto, Tori of di closure worry Lagosians sotay e dey trend for social media sef.
Traffic on Lagos roads wey third mainland bridge closure cause.
Wetin we call dis foto, Most pipo dey wonda how dem go do dia waka inside di three days wey di bridge go close.
Obalende follow block because of traffic
Wetin we call dis foto, Lagos road full no be small
Plenti moto jam for go slow as many pipo dey put head for di same way
Wetin we call dis foto, Plenti moto jam for go slow as many pipo dey put head for di same way
People stranded waiting for buses.
Wetin we call dis foto, Goment say dem dey sorry for di inconvenience wey di traffic for oda routes go cause because of di bridge closure.
Plenti pipo for bus stop
Wetin we call dis foto, Lagosians wey tanda for BRT bus pass becareful
Agege Motorway wey follow go Yaba, one of di routes wey goment say make pipo follow as dem close Third Mainland Bridge
Wetin we call dis foto, Ikorodu Road wey follow go Yaba, one of di routes wey goment say make pipo follow as dem close Third Mainland Bridge
Yaba na one of di road wey pipo follow enta Island or Mainland
Wetin we call dis foto, Yaba na one of di road wey pipo follow enta Island or Mainland