Naya Rivera body found: Police confirm dead body of Glee star American actress for California lake

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Yemisi Lanre-Idowu
- Role, Senior Broadcast Journalist
Di Ventura County Sheriff's Office for California, America don confirm di body dem find for Southern California lake say na former "Glee" actress Naya Rivera.
Di Ventura County Sheriff Bill Ayub confirm am during press conference on Monday 13th July.
Glee star Naya Rivera, 33 years, bin miss since last week Wednesday 8th July and dem presume her dead afta dem find her four-year-old son alone inside boat for Lake Piru - Reservoir in California.
Now di police discover di body on Monday morning for di Lake Piru, and dem say di bodi dey float in di northeast area of di lake where di water dey between 35 and 60 feet deep,
"We dey confident say di body we find na that of Naya Rivera," Ventura County Sheriff Bill Ayub tok.
E add " indication no dey say foul play dey or that dis na suicide."
Dem bin don take di body to Ventura County Coroner's Office, where dem go identify am through dental records.
Oga Ayub tok say di sheriff's department don dey "in direct contact" with di family of Rivera.
End of Di one wey oda users dey read well well
"Her family dey visit di lake everyday, dey get hope and dem dey communicate with our investigators," Ayub tok.
Di boat incident
Na one boater spot Rivera pikin three hours afta di actress bin don take di boat dat day, CBS Los Angeles tori pipo report am as dem dey quote police office for di area.
Di boy tell investigators say im and im mama bin dey swim but she no come back inside di boat.
Dem later identify di missing pesin to be Naya Rivera, wey be Los Angeles resident.
On Tuesday 7th July, Rivera bin post a picture of her and her son wit a caption "just di two of us".
No be Naya Rivera alone don die for 'Glee' di Fox hit series. Di series bin don see di death of oda fellow cast members cast members like Cory Monteith and Mark Salling.











