Zindzi Mandela death: Nelson Mandela daughter Zindzi die at di age of 59 - See tins wey you need to know about her

Wia dis foto come from, Getty Images/President Cyril Ramaphosa
Zindzi Mandela, di youngest daughter of South Africa first black president Nelson Mandela and anti-apartheid activist Winnie Madikizela-Mandela, don die, tori pesin for SABC report.
She die for Johannesburg on Monday morning for di age of 59.
Family pipo confam her death according to SABC.

Wia dis foto come from, AFP PHOTO / NELSON MANDELA FOUNDATION
Who Zindzi be?
She be Nelson Mandela sixth child and im second child wit Winnie Madikizela-Mandela.
Dem bin post Ms Mandela go Denmark for 2015 and dem don arrange say she go become South Africa head of mission for Monrovia, Liberia.
Ms Mandela bin grow up wen di anti-apartheid struggle serious. Na dat time her papa dey prison for Robben Island and she suffer many years of harassment and intimidation by di apartheid regime, she, her sister Zenani, and her mother Winnie, BBC' Vumani Mkhize tok.
Before her death, she dey show support for change in land reform for South Africa, our correspondent tok.
Na only two out of Nelson Mandela six children still dey alive: Zenani Dlamini, Zindzi' sister; and Pumla Makaziwe Mandela, one daughter from im first marriage, to Evelyn Mase.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dis article contain content wey Google YouTube provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Google YouTube cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of YouTube post
How she take die?
Di family never tok how but di 59-year-old daughter of former president Nelson Mandela and Winnie Madikizela-Mandela, die for Johannesburg hospital early dis morning," SABC tok.
President Cyril Ramaphosa for inside statement offer condolence to di Mandela family. He tok say Zindzi Mandela na household name and she show strength and support during di apartheid struggle.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
"Dis na untimely death. She still get role to play on how our society go take change and anoda ogbonge work to do for di African National Congress" di ANC tok-tok pesin, Paul Mabe tok.

Wia dis foto come from, Getty Images
Minister of International Relations Naledi Pandor tok say dem no go only remember Zindzi as di daughter of dia former oga but as pesin wey dey struggle for di good of di kontri in her own right."












