Lagos building collapse: 'My son die for di house wey fall'

Victim of di building collapse

Victims of di three storey building wey collapse for number 17 freeman, Lagos Island, south west Nigeria dey count dia losses.

According to eyewitness dem, di incident happun around 2:00am in di morning.

Lagos state Emergency Management agency (Lasema) tok-tok pesin, Nosa Okunbor say dem recover three deadi boi and rescue nine pipo.

According to DG of Lasema Femi Osanyintolu, one young boy dey among di two bodies wey dem comot from di collapse building.

Mr Ibrahim Balogun son na im be di young boy wey die inside di incident.

Im tell BBC say dem bin dey sleep togeda with im wife, four children and two odas wen dem begin hear noise.

Collapse

Wia dis foto come from, LASEMA

"I lost my last son Abdulsalam Balogun, e really affect me much, all my property dey dia."

"We bin dey inside dey sleep, e start around afta two, wetin we hear na girrrriiii, afta dat we rush out for di room go outside, before we reach, di house don fall."

"Na very terrible tin, I feel bitter, for me to lose my son, e dey very painful, goment suppose do something about am." Balogun tok.

Mr Balogun wey bin dey live for nuber 16, Freeman street say di building wey collapse fall ontop dia own.

Collapse Building

Wia dis foto come from, LASEMA

Osanyintolu say from preliminary report, di building wey dey Lagos Island, collapse due to structural defect and building controlling ogas dem bin don mark dat building before.

One eye witness say one of di families wey dis collapse building affect bin just newly move enta di building as di before pipo wey dey stay inside move out with di excuses say dem wan renovate am. But di developer bring in new pipo enta di building as di renovation work dey on.

Lagos no dey new to tori of building collapse.

See more pictures from di scene:

Building Collapse

Wia dis foto come from, LASEMA

Lagos Collapse building

Wia dis foto come from, NEMA

Lagos Collapse building

Wia dis foto come from, NEMA

Lagos Collapse building

Wia dis foto come from, NEMA

Lagos Collapse building

Wia dis foto come from, NEMA

Lagos Collapse building

Wia dis foto come from, NEMA