Naya Rivera death: Glee star dey presumed dead afta di American actress miss for Lake Piru boat trip wit her son wey dem find for di Reservoir in California

Naya Rivera death

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 2 mins

Glee star Naya Rivera wey miss since Wednesday dey presumed dead afta dem find her four-year-old son alone inside boat for Lake Piru - Reservoir in California.

Di 33-year-old rent di boat on Wednesday afternoon for Lake Piru, north-west of Los Angeles, di Ventura County Sheriff office tok.

Dem tok say dem don suspend rescue operation wey dem bin do overnight and "go continue at first light".

Na Rivera play cheerleader role Santana Lopez inside Glee movie series.

Naya Rivera on family matters

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Naya Rivera

Di musical comedy TV series bin show on di Fox network from 2009 to 2015.

Wetin we sabi about di about di boat incident?

Na one boater spot Rivera pikin three hours afta di actress bin don take di boat, CBS Los Angeles tori pipo report am as dem dey quote police office for di area.

Di boy tell investigators say im and im mama bin dey swim but she no come back inside di boat.

Dem later identify di missing pesin to be Naya Rivera, wey be Los Angeles resident.

On Tuesday, Rivera bin post a picture of her and her son wit a caption "just di two of us".

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

line
Naya Rivera in 2015

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Naya Rivera and Ryan Dorsey in 2015

Who be Naya Rivera?

Rivera start her career as a child actress and model, she appear for TV commercials for di US.

As a four-year-old she dey for di Royal Family sitcom, and get a number of oda TV appearances.

But na wen she play di cold-hearted role of Santana Lopez for Glee , she become star for America.

In 2014, Rivera act for di horror film At di Devil's Door.

Di same year she marry her fellow actor Ryan Dorsey - who be di father of her son.

Di couple divorce for 2018 and get joint custody of di boy.