Kanye West: American rapper, Kim Kardashian husband and Donald Trump friend tweet about running for United States Presidential Election 2020 - See facts about Kanye West you fit no know

Kanye West is running for President: American rapper, Kim Kardashian husband and Donald Trump pal

Wia dis foto come from, Kanye West

Wetin we call dis foto, American rapper Kanye West na Kim Kardashian husband and US President Donald Trump friend.
    • Author, Damilola Banjo
    • Role, Broadcast Journalist, Pidgin Service
  • Read am in 4 mins

Kanye West, di popular American rapper wey marry TV star Kim Kardashian, don enter news again afta tweet on 4th of July say him go dey among pipo running for United States Presidential Election 2020 dis November.

Di American rapper na president Donald Trump friend wey wan join politicians running for United States Presidential Election 2020 .

Di announcement of Kanye dey surprising because im be wan run against Donald Trump wey he dey always claim to admire but e also no too shock pipo as e no be im first time to say e wan run for president.

Dis na five tins wey you fit no know about di America rapper

1.Kanye West bin engageAlexis Phifer before e marry Kim Kardashian

Before Kanye tie di knot wit Kim, im first wan marry designer Alexis Phifer wey im dey date since 2002.

Dem engage for 18 month before di two wey-for-be couple say dem no do again and scatter dia engagement.

Kanye West Jesus Is King Album

Wia dis foto come from, Twitter

Wetin we call dis foto, Kanye West release Jesus Is King Album for October 2019

2. Kanye West bin suggest say African-American slavery na 'a choice'

Kanye West for May 2018 bin tok say enslavement of African Americans over centuries fit be a "choice".

"Wen you hear about slavery for 400 years ... for 400 years? Dat one sounds like a choice," Di American rapper tok during one appearance on entertainment site TMZ.

"We dey mentally imprisoned," di star add.

But di koko be say na by force dem bring black pipo from Africa to di US during di 17th, 18th and 19th centuries and sold as slaves.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

3. Kanye West na billionaire

Kanye West don wan enter billionaire list since. He even don accuse Forbes say dem no add am put for dia list sake of say im be black man but dis year, dem finally introduce di rapper to dia list.

Although Forbe and Bloomberg no fit agree on how much be di billion wey oga West get even though dem both look at di same financial documents.

According to Forbes, Kanye West networth $1.3 billion but even though Bloomberg look di document wey Kanye accountant give dem wey show say im worth $3.3 billion, Bloomberg no openly agree.

However, di American rapper dey insist say im get $3.3 billion.

Kanye West networth 2020

Wia dis foto come from, PA

4.Di American rapper own shoe brand Yeezy

Kanye West get im own shoe brand wey im dey produce with Adidas since 2013. Na wey di rapper dey always call imsef fashion designer.

Yeezy dey produce sneakers and some pipo bim think say Yeezy be di most influential brand of sneakers for di world. Di brand dey also produce shirts, jackets, track pants, socks, women's shoes.

If you dey wonder wia dis Yeezy dey come from, for September 2018 Kanye West bin change im name to Ye.

Kanye West networth

Wia dis foto come from, Getty Images

5.Kanye West want seven children

Di celebrity wey real name na Kanye Omari West don already born four children but di rapper tok for 2019 say he want seven children. He say di richest tins pesin fit get na to get plenty children.

Kim Kardashian, im wife too confam for anoda show say di Jesus Is King crooner true true want seven children.

Kim Kardashian and Kanye West name dia fourth child Psalm.

Kanye West Wash Us in Blood mp3 download

Wia dis foto come from, Rich Fury

Wetin we call dis foto, Kanye West dey perform for im Sunday Service

6.Kanye West don dey eye di White house tey tey

Kanye West don tok before say im go run for di presidency for 2015. Findings inside di America Federal Election Commission (FEC) show say one candidate with name "Kanye Deez Nutz West" register under Green Party for 2015.

He also don tok before say na 2014 im go run. For 2015 MTV Video Music Awards, im bin say im don decide to run for president in 2020. But last November im change im mind date back, saying he would actually run in di 2024 contest.

Now all dat one change on USA Independence Day wen Kanye West tweet say im dey run for president 2020.

Kanye West for president - United States Presidential Election 2020

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di American rapper bin visit Trump Tower shortly after Mr Trump win election

For im tweet on Saturday, US Independence Day, Kanye West, age 43, no say if im go rununder one particular political party.

In any case, to contest di nomination from one major parties go be impossible at dis stage, as di election be only four months away.

Wetin we call dis Video, Kanye West before e decide to run for president bin say: MAGA hat "make me feel like Superman"

For im to appear on di ballot as independent candidate, West go need gather some amount of signatures and register for states by particular deadline.

Di deadline don already passed for some major states but di music star go still fit get time to file for many oda states.