Nimi Akinkugbe: Marriage fit change woman state of origin? Wetin Nigeria law tok

Wia dis foto come from, Facebook/Nimi Akinkugbe
Opunimi Akinkugbe fit don tink say her own don beta afta Nigeria Presido Muhammadu Buhari name am as ambassador nominee for Ondo state.
She originally come from Rivers State but she marry Yinka Akinkugbe wey come from Ondo state.
Na wia pipo start to enta di same trouser with oga presido on top say she no be Ondo woman.
Tori be say di Chairmo of di Ondo Youth Coalition, Ademario Emmanuel and di presido of Yoruba Afenifere Youth Organisation of Nigeria, Eric Oluwole tok say madam Nimi no fit represent dem for National Affairs.
Di mata scata social media as pipo start to dey share dia own mata.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1

End of X post, 2

End of X post, 3

End of X post, 4
Wetin Nigeria law tok
So wetin di law tok on top di mata of where woman fit claim as her state of origin.
Lawyer, Shehu Ali Mohammed, tok say "Legally, marriage no dey change di state of origin for woman".
However, e tok say for electoral purposes, "di woman dey entitiled to two states of origin, di legal sense of it be say wen she marry, two don become one wey mean say she fit claim di state of origin of her husband or her papa. Weda na for election purpose or appointment."
End of Di one wey oda users dey read well well
Na to dey watch weda Ondo pressure go work to comot Nimi Akinkugbe nomination, but di law say she get right to dey dia.
Nimi Akinkugbe na finance and wealth management expert wey be di founder and CEO of Bestman games wey dey distribute di City of Lagos version of monopoly.
She bin work as di Regional director, West Africa of Barclays Bank and General Manager and Head, Private Banking and Director Stanbic IBTC Asset Management Ltd.