Coronavirus: WHO don declare am world emergency, see how Ghana, Cameroon, Nigeria dey fight dis respiratory sickness wey no get cure from dia domot

Wia dis foto come from, Getty Images
World Health Organization (WHO) on Thursday evening declare di novel coronavirus world emergency.
Di death toll from di coronavirus disease don rise to 170.
As at January 29, 2020, Chinese authorities confam 7,711 cases for di kontri and say di virus don spread enta every region for mainland China.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Di fact say di infection don spread enter at least 16 kontries don make kontries around di world dey at alert.
Nigeria na one of such kontries wey dey worry.
Di kontri get a number of pipo wey dey China for studies as well as pipo wey dey from dia travel to and fro China and Nigeria for business and odas.
Wetin Nigeria dey do to fight coronavirus?
On Tuesday, January 28, 2020, Nigeria Minister of Health Osagie Ehanire tok say di risk of importation of di coronavirus wey dey spread for China dey high for Nigeria but di kontri no siddon fold dia arms.

Wia dis foto come from, Getty Images
'No go China for now'
Nigeria Health Minister Osagie Ehanire don draw ear give pipo for di kontri wey dey plan go China or any of di affected kontri make dem no tink am for now.
End of Di one wey oda users dey read well well
Oga Ehanire say, "e don become necessary to issue dis travel advisory to Nigerians. Di first na say make all Nigerians and all pesin wey dey plan to go China delay dia travel plans till further notice except e important well-well."
E also ask those wey dey land di kontri from China and oda affected kontries to separate demsef from pipo fro two weeks even if dem no get any symptom of di virus.
Point of entry surveillance
Nigeria Health Minister Osagie Ehanire say di kontri don increase surveillance for all entry points into di kontri, including di five international airports, for di Federal Capital Territory (FCT), as well as Lagos, Enugu, Rivers, and Kano States.
Di Federal Airports Authority of Nigeria bin don also passengers and oda airport users to comply with all quarantine procedures for airports.
Dem add say all di equipment and personnel wey dem use to fight di deadly ebola virus for 2014 still dey kampe for di airports.

NCDC and WHO collabo
Nigeria Centre for Disease Control (NCDC) say dem dey follow di world join body ontop health mata, World Health Organization (WHO) yan closely to monitor di situation globally.
Di NCDC advice don advise Nigerians make dem remain calm.
What about citizens for China?
Di Head of di Nigerians in the Diaspora Commission, Abike Dabiri tell BBC say di commission never receive any reported incidence of Nigerians wey dey infected by di coronavirus for China.
She tok say some Nigerians wey dey live for China, particularly students don rush go di kontri mission office.
She add say dem dey maintain constant touch with those wey no fit come di mission. According to her, di diaspora commission and di Nigeria foreign affairs ministry dey work out how to help citizens even if dem have to evacuate them.
Wetin oda west african kontris dey to fight di disease?

Ghana start dey intensify coronavirus screening for dema airports den sea ports in order to prevent de disease from entering de country.
De Ministry of Health dey collect detailed travel information from Chinese visitors den all international visitors so say dem fit track de movement of pipo den whether dem fit be exposed to de virus.
According to de ministry besides health declaration forms, dem dey use three thermal scanners take check possible cases on arrivals, wey dem get holding room on standby for passengers wey go display symptoms of coronavirus.
Public Relations Officer (PRO) for de ministry, Elorm Ametepe explain say dem "prepare more centres for highly populated areas like Accra, Kumasi, Takoradi den Tamale," as part of de preventive measures against de virus.
De business community for Ghana also advise dema members say make dem no go on trips to China around dis time sake of de virus.
De Health Ministry say dem in de event say dem record possible case, de Greater Accra Regional den Tema General hospitals go manage am.
While Noguchi Memorial Institute for Medical Research (NMIMR) go dey in charge of chook eye inside any suspected case of de virus.
Ghana Union of Traders Association (GUTA) also talk dema members say make dem avoid business trips to China around dis time.
More Ghanaians dey travel go China dey import goods to de country, but GUTA say make dem avoid den trips for now to reduce risk of infection.

Wia dis foto come from, Getty Images
For Cameroon, di Minister of public health release press statement to inform di kontri pipo say make dem shine dia eyes well and respect di basic hygiene rules
- Wash your hand every time with clean water and soap and use hydro alcoholic solution
- Cover nose and mouth wen dem dey cough or sneeze
- Im say make dem avoid anybodi wey get symptoms of flu or anybody wey don get contact with wild animal and farm animals
- Cook beef and eggs well before you chop am
Im add am say anybodi wey don travel out of Cameroon or wey don get contact with any sick traveller and wey don get di symptoms wey dem mention above in di last 14 days ,say make dem report di case shaperly for proper care.











