Orange, oda fruits & vegetable dey boost immune system - Medical expert

Wia dis foto come from, Getty Images
Orange na one fruit wey pipo fit chop to guard against yama-yama diseases wey dey happun all around dem, according to experts.
Two medical experts wey follow BBC tok, say fruits, particularly orange get plenti Vitamin C and oda important nutrients wey get power to fight diseases.
Oranges get Vitamin B, potassium, Phosphorus, Magnesium and copper.
Consultant of Nephrologist and Renal transplant physician, Dr Fagboyega Faponle for Zenith Hospital Abuja advice say make pipo add orange to dia food as e get ability to boost immune system.
Green vegetables, bell peppers, garlic and oda fruits like strawberries, mangoes, pineapple and apple also dey help guard against yama-yama diseases outbreak.
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post

Wia dis foto come from, SIMON MAINA
Dr Ese Akinyemi wey be medical practitioner for Oklahoma USA and Dr Faponle also advise make pipo dey use face mask.
E dey important make pipo dey use face mask since some of dis yama-yama diseases dey spread through air or contact with pesin wey get am, di two doctors add.









