'Every foreign student here wan go home' - Ghanaian student inside Wuhan lockdown
One Ghanaian student don tell BBC about di serious gbege wey foreign students dey inside for di Chinese city of Wuhan, wey don dey on lockdown afta di deadly outbreak of di new coronavirus.
On Monday, Chinese Premier Li Keqiang visit Wuhan, di capital of Hubei province and centre of di outbreak.
Di number of people for China wey di virus don kill don rise to 81, and almost 3,000 dey confamed say dem sick.
For BBC Newsday interview, di student, wey no want make we release im name say:
"Fear dey catch us because di numbers dey increase. For di hostel if you meet somebody dem go move go di oda side of di corridor. Nobody wan jam anybody.
Di ladies dey cry. Dem wan return back home. Dem dey panic. Dem dey lose hope. We no want stay here."







