Police shut down 'illegal orphanage' rescue 27 children for Kano, Kaduna

Authorities for Nigeria don shut down and rescue 27 children from one 'illegal orphanage' for Kano and Kaduna states for north west Nigeria.
Di children dey between di age of three to 12.
Police tok-tok pesin for Kano command, DSP Abdullahi Haruna, tell BBC say dem rescue about 19 children from Du Merci orphanage Kano, and anoda eight from Du Merci orphanage for Kaduna wit helep from di National Agency for di Prohibition of Trafficking in Persons (NAPTIP).
Police say di orphanage na fake, but Du Merci orphanage lawyer say dem dey legal.
DSP Haruna say. "dis man dey run dis orphanages for many years witout any clearance from goment or any registration wey dey very wrong, everytin get procedure and e suppose follow am from di start."
"We rescue 19 children from Du Merci orphanage for Kano and 8 from dia Kaduna branch wey make di total 27 children, we don take all di children to ministry of women affairs and social development and we don dey prosecute Professor Solomon for court." Haruna tok.
Barrister Offiong wey be board member and lawyer for Du Merci orphanage tell BBC say dem dey operate legally as dem get papers.
Di lawyer add say similar thing happun for 2002 during di tenure of former Kano govnor Rabiu Kwankwaso but court later clear di orphanage to continue.
End of Di one wey oda users dey read well well
"For 2002 dem cari both Professor Solomon and his wife (owners of the orphanage) go court and court clear dem and di orphanage continue im work. So I surprise now as anoda issue dey come up."
"Du Merci na legal orphanage wey no break any law."

One pesin wey dey live near di orphanage for Kano tell BBC Pidgin say im no eva notice anytin out of place for di plenti years wen im dey live near di place.
Wen BBC visit di orphanage on Thursday, dem tok to Samuel Tarfa and Jesse Tarfa, di two of dem dey 27 years.
Dem don live for Du Merci all dia life and don go school graduate. Di two say notin bad dey happun dia.
"Du Merci for di past 27 years show me notin but love, a be Marine Engineer now I study for Maritime Academy for Oron and na Du Merci do everytin for me, so we no happy wit wetin dey happun."
Jesse Tarfa na anoda graduate and finish im NYSC recently and e yan say both Professor Solomon and im wife wey dey run di place na good pipo.
For statement wey Kano govnor special adviser on child welfare and women mobilisation Fatima Abdullahi Dala release, she say Du Merci don dey operate for di state for 25 years without licence and checks wey goment suppose dey do from time to time.
She also add say make Kano pipo open dia eyes more to report any illegal activity for dia area.
We don update dis tori with Du Mercy orphanage side of di tori.













