Police rescue 259 pipo from Oyo 'torture house'

Wia dis foto come from, Reuters TV
Police don rescue 259 pipo from one 'torture house' for Oyo state south west of di kontri.
Some of di victims wey di police release include one small pikin, women and men for di 'torture house' for Ojoo area of di state.
One of di victim wey no gree tok im name say "some of us get plenti disease for body if we comot our cloth you go no go believe am" na wetin im tok
Tori be say some of di victims don dey place between two and ten years.
Commissioner for Police, Shina Olukolu say dem don arrest five suspects wey dem claim say dey run di 'torture house' for di state.
Alfa Ismail, na one of di suspect wey police arrest im say di work dem dey na to pray for di pikin dem.
"Na dia parents carry dem come say dem dey smoke indian hemp, drink, waka for night and dey follow cultist. We dey use di Quran take change dem." na wetin Alfa Ismail tok.
Ova di last one month dem don rescue ova 1000 pipo from religious centres dem where dem keep pipo for terrible conditions.
End of Di one wey oda users dey read well well
For September police rescue nearly 500 men and boys for one building for Kaduna state, wey dem bin dey use as Islamic school and correctional facility.
Oga Olukolu tok say di police work neva finish as dem still dey find oda young boys dem to free from dis kain katakata.













