World Cup draw: Cameroon vs Brazil, Ghana go meet Portugal for group stage of Fifa 2022 World Cup

Five African teams wey qualify to represent di continent for dis year Fifa World Cup don know who be dia opponents.
Africa Cup of Nations champions, Senegal dey di same group wit hosts Qatar, Ecuador and Netherlands.
Ghana wey beat Nigeria to progress to di tournament go meet Cristiano Ronaldo Portugal for group stage. Di Black Stars go also meet Uruguay and South Korea for Group F.
Di World Cup go take place between 21 November and 18 December for Qatar, di opening match go see di hosts play Ecuador for di tournament.
Morocco dey drawn against 2018 third place team, Belgium and Croatia wey play di final for dat year tournament too.
Cameroon go square up against heavyweights Brazil for Group G. Serbia and Switzerland also dey for di Indomitable Lions group.
For Tunisia, dem go play current champions France for Group D. Di North African side go also meet Denmark and di winner of di play-off wey involve UAE/Australia/Peru. Dat play-off match go hold sometime for June.
World Cup Groups
Group A: Qatar, Ecuador, Senegal, Netherlands,
End of Di one wey oda users dey read well well
Group B: England, Iran, USA, Wales/Scotland/Ukraine
Group C: Argentina, Saudi Arabia, Mexico, Poland.
Group D: France, UAE/Australia/Peru, Denmark, Tunisia.
Group E: Spain, Costa Rica/New Zealand, Germany, Japan.
Group F: Belgium, Canada, Morocco, Croatia.
Group G: Brazil, Serbia, Switzerland, Cameroon.
Group H: Portugal, Ghana, Uruguay, Korea.
Why we no know all di teams?
Usually all di teams go dey known before di World Cup draw but dis year three positions neva dey decided for two different reasons.
Two intercontinental finals go happun for Qatar on 13 and 14 June. Costa Rica and New Zealand go meet for one and for di other Peru go play di winner of di United Arab Emirates v Australia, dem go meet for di Asian play-off in Doha on 7 June.
Dem move dose games from March becos of knock-on effects of di Covid pandemic for each continent. All di Oceania qualifiers take place from 17 to 30 March for mini-tournament for Qatar.
One of di three European play-off routes don dey delayed becos of di Russian invasion of Ukraine.
Scotland semi-final against Ukraine for Hampden Park dey postponed from March until unspecified date for June wen hope dey say Ukraine go dey in a position to play.
Di winner of that game go face Wales, wey beat Austria for di semi-final, for Cardiff a few days later to clinch World Cup ticket.














