Algeria vs Cameroon: Away goal world cup qualifiers - How Fifa rule help Ghana and Cameroon qualify for World Cup

Wia dis foto come from, GFA and Getty Images
Cameroon and Ghana book dia place for dis year Fifa World Cup for Qatar thanks to away goals rule.
Di indomitable Lions wey bin suffer 1-0 home defeat last Friday shock Algeria for Blida as dem win di return leg 2-1.
Di match finish 2-2 on aggregate but Cameroon progress to di World Cup group stage as dem bin score more goals away from home dan di number wey di Atlas Lions bin record for Yaounde.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
For Ghana, na dem produce wetin arguably become di shock of di play off round as dem upset fellow West African country, Nigeria.
Di tie end 1-1 for Abuja and e see di Black Stars progress as di two sides bin draw goalless for Kumasi.
Wetin be away goal rule?
Despite say European body UEFA scrap di away goals tiebreaker for dia club competitions for 2021-22, di rule still dey take effect for Fifa World Cup qualifying, including any two-leg playoffs wey hold around di world.
Di Fifa away goal rule wey don dey in place tey tey play major role for di two matches wey involve Ghana and Cameroon.
According to Fifa: "Di aggregate score, wey be di team wit di most goals from di two matches, go determine di winner of Home & Away competition. If di game still dey tied, di side wit di most away goals go dey declared as di winner."
End of Di one wey oda users dey read well well
Away goal rule scenario include:
- If both teams score di same number of goals over two matches, di goals wey dem score for away go count as double.
- If both teams score di same number of goals, di match go enta extra-time and possibly penalties.
African qualification for World Cup don use away goal rule before?
Di short ansa, na yes.
For 2014 Algeria use di away goal rule to qualify for di World Cup afta dem draw 3-3 wit Burkina Faso on aggregate.
Di first leg for Ouagadougou bin end 2-2 while di return leg for Algeria finish 1-1.
Why only one example of such use of di rule dey na because Fifa over di years don change di way qualification for football biggest competition dey be.
African teams wey qualify for Qatar 2022 World Cup
All five teams wey go represent Africa for dis year World Cup don dey known.
Tunisia, Ghana, Senegal, Morocco and Cameroon na dem go represent di continent for dis November tournament.













