Wolves: Nuno Espirito Santo to leave afta four years as manager

Nuno Espirito Santo

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Wolves enjoy dia best-ever Premier League finish under Nuno - seventh in each of di last two seasons

Portuguese manager Nuno Espirito Santo go leave Wolves for di end of di season by mutual agreement.

Di former goalkeeper leave Porto to take charge of di club for 2017 and Wolves win di Championship title for im first season.

Afta e finish seventh for di Premier League for di last two seasons, di 47-year-old sign three-year contract extension last September to 2023.

Wolves dey 12th heading to di final game of di season at home to Manchester United on Sunday.

"Since di first day we land for Compton [training ground], our ambition na to make positive change and push dis football club forward," Nuno tok.

"I dey proud to say we do dat every single day. We achieve our goals, we do am with passion and we do am togeda."

"Sunday go be very emotional day but I dey so happy say di fans go dey back in Molineux and we fit share one last special moment togeda, as one pack."

Jeff Shi, di club chairman, tok say: "Nuno don bring us some incredibly special moments for Wolves wey we no go eva forgot but every chapter go come to end.

"We no fit measure e loyalty and dedication ova di last four years and we no fit thank am enough for di progress wey e don make for Wolves.

"Sunday already go be very special day, welcoming our supporters back for di first time for more than one year, but e go also now be fitting goodbye for someone wey go forever remain one important part of Wolves history."