Dangote wan drop money to repair Moshood Abiola National Stadium

Nigeria Golden Eaglets player and Switzerland player for Abuja National stadium, 2009

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 2 mins

Minister of Youths and Sports Development, for Nigeria Sunday Dare, say Africa richest man Aliko Dangote godo collabo wit goment to repair di Moshood Abiola National Stadium for Abuja, di kontri capital.

Di $360m stadium wey be di official home for Nigeria national sport teams don turn to something else, 16 years afta dem launch am for 2003.

For inside tweet oga Dare thank oga Dangote and im company say dem "partner" with im ministry to repair di field and score board.

Aliko Dangote

Wia dis foto come from, STEPHANE DE SAKUTIN

Wetin we call dis foto, Aliko Dangote don dey successful from cement, enter sugar, to oil business

Local tori pipo, The Cable also report on Friday say oga Dare follow journalists tok say repair work go start in one or two weeks time.

On 12 June 2019, President Muhammadu Buhari officially add 'Moshood Abiola' to di name 'National Stadium' to take honour di late political big man and former presidential candidate wey pipo believe say win di 1993 elections.

Moshood Abiola National Stadium for 2019 and 2009

Wia dis foto come from, Apple Maps/Getty Images

Wetin we call dis foto, 10-year challenge for Moshood Abiola National Stadium
Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Wen Nigeria use di national stadium take host di Fifa U-17 World Cup for 2009, di grass ontop di field still green well-well and facility dey work. But today, na di opposite.

Many of di stadiums for di kontri, like many goment structures, no dey get regular maintenance and dis na wetin fit don make di stadium bad well well.

Nigeria Golden Eaglets tanda for stadium, 2009

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di grass still green for di stadium for 2009