MKO Abiola: Buhari change Abuja national stadium name to honour di late icon

Wia dis foto come from, TWITTER/BashirAhmad
Nigeria President Muhammadu Buhari don change di name of Abuja national stadium to Moshood Abiola to honour di late MKO.
President Buhari propose dis wan on Wednesday, for di kontri Democracy Day celebration on Wednesday.
Africa presidents, dignitaries and oda VIPS dey Abuja, di Nigeria capital to mark di kontri Democracy day.
For inside im inauguration speech, di president also call on everybody to join hand epp move di kontri forward. Im promise say im goment go improve on im administration achievements.
"Throughout my career I don be public servant, so my aim na to dedicate my life to work for di good of Nigeria.
"We dey work to comot di pipo from poverty. E no dey impossible, India don do am, China don do am Indonesia too, Nigeria fit do am. With leadership and sense of purpose we fit lift 100 million Nigeria from poverty in 10 years." Na so Buhari tok.
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post
Buhari also promise to work with di private sector, to increase productivity and growth.
"E dey take too long for goods to clear for ports, and di roads no good, dis issues dey worry and we dey committed to face di issues.
End of Di one wey oda users dey read well well
"Wen we enter we realise say if we fight corruption, e go fight back, we don take our eye see am." Na so Buhari tok.
Di President also encourage govnors to invest in dia states.
Nigeria dey observe di day for di first time afta President Muhammadu Buhari make am law for 2018 say June 12 go be di new Democracy Day and public holiday for Nigeria, to mark di day wey di kontri do election for 1993, wey sabi pipo don judge say na di freest and fairest wey di kontri don ever do.
Na also day to celebrate di winner of dat election, late Moshood Abiola (MKO) wey die for detention on July 7 1998 under circumstances wey pipo still dey suspect.











