May 29 2019 in Nigeria: Muhammadu Buhari no give inaugural speech afta e take oath of office for second term wit Security & Poverty as im biggest challenge

Buhari, Osinbajo take 'Next Level' oath

Wia dis foto come from, Bashir Ahmad

    • Author, Daniel Semeniworima
    • Role, BBC Pidgin, Lagos
  • Read am in 3 mins

President Muhammadu Buhari and im deputy, Professor Yemi Osinbajo, don take dia 'Next Level' oath of office as elected President and Vice President of di Federal Republic of Nigeria for second term wey go last anoda four years.

But oga Buhari no give inaugural speech afta e take oath wit Security & Poverty as biggest challenge for im second term.

Dis go be di first time since 1999 wey any Nigerian leader no go give speech after im inauguration. But e follow for di plan of goment to make June 12 Democracy Day big pass di May 29 Swearing - In of President Buhari.

Vice President Yemi Osinbajo take im oath at about 10:30 am togeda wit im wife, Dolapo.

President Buhari take im oath at about 10:45 am o togeda wit im wife, Aisha.

Na di Acting Chief Justice of Nigeria, Justice Mohammad Tanko, swear in President Muhammadu Buhari.

Vice President Yemi Osinbajo take im oathat about 10:30 am on Wednesday togeda wit im wife, Dolapo.

Wia dis foto come from, Bashir Ahmad

Wetin we call dis foto, Vice President Yemi Osinbajo take im oathat about 10:30 am on Wednesday togeda wit im wife, Dolapo.

Di inauguration event take place on Wednesday morning for Eagles Square, Abuja inside di kontri capital.

Live inauguration video from Eagle Square, Abuja:

Skip Facebook post, 1

Content is not available

View content on FacebookDe external site no concern BBC.

End of Facebook post, 1

How to lift 93 million Nigerians out of poverty and reduce security palava for di kontri go be di major challenge Buhari and Osinbajo must face before dia tenure go expire 2023.

Tori be say Boko Haram, herdsmen, kidnapping and kill kill dey happun anyhow across Nigeria now.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

For dis im second term as elected presido, Buhari tell one national TV on Monday night say im go pay more attention to di police and courts to make dem work beta so dat security and justice system go improve.

From midnight till 3pm on Wednesday May 29, some roads inside Abuja go dey blocked sake of di presidential inauguration.

Buhari

Last night all di Ministers wey bin work wit oga Buhari for im first term hand over to di Permanent Secretary for dia Ministries.

President Muhammadu Buhari don be military Head of State between 1983 and 1985 wen him be Army General so dis na him third journey inside di office of di president.

Since 1999 Nigeria Democracy never get any interruption from military coup.
Wetin we call dis foto, Since 1999 Nigeria Democracy never get any interruption from military coup.

Na him (Buhari) be di number 15 Head of State and President of di Federal Republic of Nigeria since 1960 wen di kontri gain freedom from Britain.

Nigeria goment bin don confam say na small occasion go shelle on May 29 for di swearing-in of Presido Muhammadu Buhari for second term.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Skip Facebook post, 2

Content is not available

View content on FacebookDe external site no concern BBC.

End of Facebook post, 2

Di kontri Minister of Information Lai Mohammed say di reason be say most of di events go happen for June 12, wey be di new Democracy Day for Nigeria.

Dis na di list of roads wey go block on May 29 inside Abuja

Wia dis foto come from, Presidency

Wetin we call dis foto, Dis na di list of roads wey go block on May 29 inside Abuja

Di Code of Conduct Bureau wey be Nigeria special office wey dey check di amount of money and property of politicians don clear oga Buhari and im Vice Yemi Osinbajo say dem no get anytin (no new house, now bank account or od property) to hide.

Meanwhile Govnors go also take oath of office for fresh four year tenure inside 30 states except Ondo, Bayelsa, Kogi, Anambra, Osun and Ekiti states.

Gov. Bello of Kogi, Akeredolu of Ondo, out-going Gov. of Zamfara Abdul-aziz Yari Abubakar all show face for Eagle square

Wia dis foto come from, BASHIR AHMAD

Wetin we call dis foto, Gov. Bello of Kogi, Akeredolu of Ondo, out-going Gov. of Zamfara Abdul-aziz Yari Abubakar all show face for Eagle square

Some of dis govnors like Nyesom Wike of Rivers, Emmanuel Udom of Akwa Ibom, Nasir El-Rufai of Kaduna and Abdullahi Ganduje of Kano go return for second term like oga Buhari, while some oda govnors like Babajide Sanwo-Olu of Lagos, Emeka Ihedioha of Imo and Bello Muhammad Mutawalle of Zamfara go enta office of di govnor for fresh tenure of four years.

Former Head of State Yakubu Gowon also show face for di event.

Wia dis foto come from, BASHAIR AHMAD

Wetin we call dis foto, Former Head of State Yakubu Gowon also show face for di event.
APC National Chairmo Adams Oshiomole, APC Leaders Bola Tinubu and Bisi Akande all of dem show for di inauguration.

Wia dis foto come from, BASHAIR AHMAD

Wetin we call dis foto, APC National Chairmo Adams Oshiomole, APC Leaders Bola Tinubu and Bisi Akande all of dem show for di inauguration.