Zlatan Ibrahimovic no go play for 2018 World Cup

Dis na picture of Ibrahimovic wia im dey trap ball

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Ibrahimovic play im last game for Sweden for Euro 2016

Zlatan Ibrahimovic no go comot from retirement to play for Sweden for di 2018 World Cup for Russia.

Di striker bin talk before say im go-go Russia for World Cup but no talk weda im go play.

Oga pata pata for Sweden Football Association Lars Richt yan say im don talk with Ibrahimovic, but e no change anything.

Picture of wia Ibrahimovic dey drible anoda player

Wia dis foto come from, Alex Livesey

Wetin we call dis foto, Ibrhimovic don play for big-big football club like Barcelona and Man U

Ibrahimovic retire from international football after im play for EURO 2016.

Di 36 years old player don go two World Cup before for 2002 and 2006. Im don score 62 goals for 116 games for im kontri.

Dis na di first time wey Sweden go play for World Cup since 2006.