Why Man U sign Ibrahimovich again

Wetin we call dis Video, Zlatan Ibrahimovic don re-sign with Man U
Read am in 1 mins

Manchester United don sign another one year deal with striker, Zlatan Ibrahimovic.

Di 35-year-old striker wey bin dey play for Sweden score 28 goals after e show 46 times for Man U last season.

Zlatan Ibrahimovic dey expected to recover well-well by December

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Ibrahimovic dey expect to recover well-well by December

Man U bin don tell Ibrahimovic bye-bye after im get premature injury for knee, but di player dey ready to return to field.

Im dey recover for United training ground after doctor do surgery for im knee.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Man U manager, Jose Mourinho, talk say "after wetin im contribute last season, we get mind say im go deliver and we go wait make him return."

Ibrahimovic bin first join di Red Devils on free transfer for July 2016.

Ibrahimovic say: "I don show to finish wetin I don start. E don already be my own and e dey my mind to stay for di club."

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2