Tobi Bakre wedding, wife Anu Oladosu: BBNaija ex housemate Lagos wedding highlight

Tobi Bakre wedding, wife Anu Oladosu: BBNaija ex housemate Lagos wedding highlight

Wia dis foto come from, Tobi Bakre

Wetin we call dis foto, Tobi Bakre and wife
Read am in 1 mins

Tobi Bakre wedding on Saturday see di former BBNaija housemate marry Anu Oladosu.

Di event feature both Yoruba introduction rights and reception parties.

Di couple dey also expect pikin wey dem reveal for di wedding party.

Oga Bakare bin first show off Anu for March 2020 inside social media e post.

For di video dat time dem bin dey do dance inside challenge.

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post

Celebrities grace di wedding wey happun for one location inside Lagos.

Sophie Alakija, Adesua Etomi Wellington, musician Timi Dakolo follow show face.

Timi Dakolo also sing for di couple for dia reception.

Tobi Bakre wedding, wife Anu Oladosu: BBNaija ex housemate Lagos wedding highlight

Wia dis foto come from, Instgram

Wetin we call dis foto, Actresses, Lala Akindoju and Adesua Etomi-Wellington as well as social media celeb, Mariam Bakare show up for di wedding

Tobi Bakare neva gist di public about im relationships.

Although at some point im be dey lined with fellow Big brother Naija housemate, Alex.

Who be Tobi Bakre wife, Anu Oladosu?

Nothing much don comot about Anu Oladosu di pregnant wife.

She first enta spotlight as di soon to be bride of Tobi for February 2021.

For di now deleted Instagram post, Tobi Bakre carry am go di Headies Awards.

Afta dat, for June 1, she bin wish am happy birthday.

Di expectant mother bin don do some modelling for 2013.

Dat time she contest for di Miss University Nigeria pageant as Miss Unilag.