Pregnancy tourism: 'Dis women dey come meet us just to carry belle'

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Deepak Sharma
- Role, BBC News
- Read am in 4 mins
One German woman come Ladakh, she spend days dey have affair wit one local man.
She come here just to come carry belle. Na why she travel from far, from her own kontri to start relationship wit foreign man?
Di reason na di pipo of Brokpa community wey dey here.
For di Indus Valley of Ladakh, e get villages wey dem dey call Biyama, Dah, Hanu and Darchik. Di 5,000 pipo of di Brokpa community wey dey live here consider demsefs to be of 'pure' Aryan descent.
Thanks to internet promotion and dissemination, information about Brokpa pipo don reach evri corner of di world. Foreign pipo dey come here for 'pregnancy tourism'.
Many pipo tok say dis Brokpa pipo na 'Aryans'. Na why foreign women dey come here wit di intention to carry belle, so dem dey connect wit local men so dem go fit born pure Aryan pikin.

Wia dis foto come from, RAJESHJOSHI/BBC
But di Brokpa pipo no too like to tok about am. Dem believe say e go bring disgrace to dia community.
Some evidence dey for di documentary 'The Eighth Baby... In Search of Purity'. Dis documentary na Sanjeev Sivan produce am for 2007.
One shopkeeper from Batalik village bin share di information on condition of anonymity.
'A few years back, I spend few days for hotel for Leh wit one woman from Germany. Afta a while, she carry belle. Some years later, she come visit me wit her pikin.'
Wetin be di characteristics of dis community?

Wia dis foto come from, RAJESHJOSHI/BBC
Dis community consider demsefs 'pure Aryan'.
One girl wey dem dey call Lhamo from di Brokpa community tok say, 'We grow up to hear say we be Aryans. You fit don hear say Aryans dey tall. All di men for our community dey tall. We dey worship nature, na dis one be proof say we be 'pure Aryans'.'
Compare to oda places for Ladakh, di faces of pipo for di villages of Biyama, Garkone, Darchik, Dah, and Hanu dey look veri different.
Few years ago, genetic research show say di Aryans fit don come India from outside.
Vedic culture influence dey show for di rituals of di Brokpa pipo.

Wia dis foto come from, RAJESHJOSHI/BBC
Swang na teacher for Kargil college for Brokpa and e dey research on di Brokpa mata. E tok say, "Our culture dey relate to Vedic culture. Our language get influence from Sanskrit. For example, we dey call horse ashwa. We dey worship gods and goddesses."
Some historians don research on top dis mata. Historian AH Frankie don mention dis "pure Aryan" pipo for im book "History of Western Tibet".
"Many authors dey claim say we be descendants of Alexander di Great," Swang tok.
On di oda hand, di Kalash tribe for Pakistan-occupy Kashmir, and pipo from Malana and Bada Bhangal villages for Himachal Pradesh dey also tok say dem be descendants of Alexander.

Wia dis foto come from, Getty Images
Wen you look di folklore of di Brokpa pipo, you go see some tins. Dia ancestors come from western Himalayas to Gilgit-Baltistan for seventh century, wey dey part of Pakistan-occupied Kashmir now.
Di Brokpa pipo dey organise festival wey dem dey call Bonona evri year for October. Dis festival dey celebrated for evri village wey di Brokpa pipo dey live. But di Aryans wey dey live for di oda side of di border for Pakistan don convert to Islam. So, e dey doubtful if dem dey celebrate di festival dia.
Di Brokpa community dey depend on agriculture, while some dey serve for military. But dia next generations wan learn.
Dia standard of living don improve since smartphone come. Through social media, dem dey stay in touch wit odas from dia community on di oda side of di borders.

Wia dis foto come from, RAJESHJOSHI/BBC
Lhamo tok say, "We dey communicate for our dialect. Dem also dey proud say dem be Aryans."
On if dem go go Patna for job, Sewang say, "Na big challenge to get job while we dey preserve our identity." Dis pure Aryans of di 21st century dey figh not for di state, but for employment. But dem say dem no dey ready to give up dia identity for employment.
(Na BBC Telugu publish dis tori first for 2018.)










