Wetin di 2026 Lunar Year of di Fire Horse mean for you

Lantern installations are seen during the Qinhuai Lantern Festival at Fuzimiao, Confucius Temple, in Nanjing, China

Wia dis foto come from, Getty Images/NurPhoto

Read am in 4 mins

Millions of pipo around di world dey celebrate di start of di Lunar New Year, as jolly dey take place from Hong Kong to Buenos Aires.

Di Lunar New Year, wey fall on di same day wit di first new moon of di lunar calendar, na one 15-day festival wey go hold between 21 January and 20 February every year.

In accordance wit di Chinese zodiac, dis year mark di Year of di Fire Horse.

E mark di end of di year of di Snake.

Parades, workshops and traditional activities go happun across di south of England as pipo come out to welcome di new year.

Hia na wetin to know about di 2026 Chinese New Year plus di behind di Year of di Fire Horse.

Fire Horse

Wia dis foto come from, NurPhoto via Getty Images

For Chinese tradition, each year dey represented by one of 12 different animals, wey feature for di Chinese zodiac: Rat, Ox, Tiger, Rabbit, Dragon, Snake, Horse, Goat, Monkey, Rooster, Dog and Pig.

Each animal get year wey dey dedicated to dem once every 12 years, for inside di cycle.

Also, na five elements dey within di Chinese Zodiac: Wood, Fire, Earth, Metal and Water, wey dey also rotate depending on di year - 2026 na di year of di Fire Horse.

Di collabo na sake of one pairing between one of di 12 animals for di zodiac and one of di five elements - wood, fire, earth, metal and water.

Each unique pairing between one animal and element dey carry different energy and e dey come around once every 60 years.

According to Chinese tradition, di horse represent freedom and speed, while fire represent intensity and urgency. Dis one mean say dis year of di Fire Horse fit bring both chaos and opportunity.

For di Chinese zodiac, di horse dey known for dia vitality, confidence, adaptable, energetic, outgoing, positive, ambitious, intelligent and adventurous, but dem fit dey a little outspoken, self-centred and stubborn, Chinese astrology experts tok.

But di Fire Horse carry more worrying meaning for Japanese culture.

For 1966, during di last year of di Horse, Japan birth rate bin reduce well-well, thanks to one superstition wey tok say women wey dem born for di year of di Fire Horse go bring bad luck to dia families.

Di sabi pipo say pipo wey dem born for di Horse dey - adaptable, energetic, outgoing, positive, ambitious, intelligent and adventurous, but dem fit dey a little outspoken, self-centred and stubborn.

Which animal you be for di Chinese Zodiac?

Chinese zodiac symbols

Wia dis foto come from, Getty Images

Check di animal year dem born you:

Year of di Horse include 2026, 2014, 2002, 1990, 1978, 1966, 1954, and 1942.

Year of di Tiger (2022, 2010, 1998, 1986, 1974, 1962, 1950, 1938)

Year of di Goat (2015, 2003, 1991, 1979, 1967, 1955, 1943, 1931)

Year of di Dog (2018, 2006, 1994, 1982, 1970, 1958, 1946)

Year of di Rat (2020, 2008, 1996, 1984, 1972, 1960, 1948, 1936)

Year of di Ox (1949, 1961, 1973, 1985, 1997, 2009, 2021)

Year of di Snake (2025, 2013, 2001, 1989, 1977, 1965, 1953).

Fotos from di 2026 Lunar New Year celebrations

One dragon dey dance for Macau

Wia dis foto come from, Getty Images

Pipo dey watch di new year celebrations

Wia dis foto come from, Getty Images

Hundreds turn out to watch di traditional lion dey dance.

Wia dis foto come from, SUPPLIED