Nigeria set new rules for Facebook, Twitter, Instagram

National Information Technology Development Agency

Wia dis foto come from, NITDA

Di National Information Technology Development Agency (NITDA) don sama one new regulations for Internet platforms wey dey Nigeria.

According to one statement wey NITDA tok tok pesin, Hadiza Umar sign, di new code dey designed to protect di “fundamental human rights of Nigerians and non-Nigerians wey dey live for di kontri.

Dem also give guidelines of how to exchange tok-tok wey go dey safe for di digital ecosystem.”

Wetin dey di new digital Code

Internet platforms ghas to “register wit di Corporate Affairs Commission (CAC) and appoint kontri representative wey go dey relate wit Nigeria authorities.”

Also di platfroms must obey all regulatory demand and follow all tax obligations wey dey ground for dia operations under Nigerian law.

NITDA further add say Internet tok-tok platforms ghas “provide one big compliance mechanism so dem go fit avoid to dey post content wey dey prohibited and bad behaviour for dia platform.”

Digital platforms ghas “provide informate to authorities about harmful accounts, suspected botnets, troll groups.

And other coordinated disinformation networks and deleting any information that violates Nigerian law within an agreed time.”

How platforms go treat Disinformation and Misinformation

As Disinformation and Misinformation dey amiong wetin dey cause egbege for di kontri, NITDA, NCC and NBC sabi say to counter dis no be for only one pesin so platforms ghas join hand wit agencies to tackle di gbege. And dis be wetin dem suppose do.

-Dey familiar wit indigenous and context tok tok wey dey cause

disinformation and/or misinformation and tins wey dey ginger di spread for Nigeria.

- Collaborate and invest for continuous and consistent research wit indigenous academics, media organisations, journalists, civil society organisations, goment agency, and on wetin dey and di tin disinformation and misinformation fit cause for Nigeria and provide ogbonge response.

- Provide independent researchers, media organisations, journalists, civil society organisations, goment agencies, access to necessary data so em go fit research and tackle disinformation and misinformation.

- Independently organise and conduct media literacy program that educate users for critical thinking and better decisions when dem jam informate wey no dey true online.

-Join hand wit local tori pipo, journalists, civil society organisations, authorised goment agencies, and oda stakeholders to organise and do media literacy program to educate users for critical thinking and informed decisions wen dem jam informate wey no dey true.

 - Engage sabi pipo factcheckers to know informate wey dey try

disinform or misinform users for Nigeria.

- Wia informatewey no dey true fit cause gbege, , public disorder, or

exploitation of pikin, di Platform go caution di publisher and comot di

content as soon as e dey ok.

a. User no go dey liable, without intention, for only redistributingthrough intermediary, di content wey dem no be di authorand wey dem no modify.

- Provide users wit easily accessible tools to report disinformation and/or misinformation and improve access to different authentic source wit alternative perspectives.

- Prioritise authentic information for search, feeds, or oda distribution channels.

-Trace, expose, sanction, and close accounts and sources wey amplify disinformation and misinformation.

Who get hand for dis new rule

Di Information Technology join bodi say di new rules dey “developed for collaboration wit di Nigerian Communications Commission (NCC) and National Broadcasting Commission (NBC).

And Interactive Computer Service Platforms like Twitter, Facebook, WhatsApp, Instagram, Google, and Tik Tok odas also get contribution.

“Oda stakeholders wey be sabi pipo for dis area also dey consulted, like Civil Society Organizations and sabi pipo groups.

Di results of di consultations go dey duly incorporated into di Draft Code of Practice.” NITDA add.

NITDA com cut warning say di Internet platforms ghas sharpaly obey court orders wey direct dem to drop “informate under under dia domain or any helep to any authorised goment.” dem tok.

Kashifu Inuwa Abdullahi

Wia dis foto come from, NITDA

Wetin be NITDA

Di National Information Technology Development Agency (NITDA) work be to implement di National Digital economy policy for digital Nigeria.

Dia mandate be to create structure for planning, research, development, standardize, applly, coordinate, monitor, evaluate and regulate of Information Technology practice for Nigeria.

Di name of dia oga of di agency be Kashifu Inuwa Abdullahi, CCIE.