Former Congolese president chop sentence to death for war crimes

Wia dis foto come from, JOSPIN MWISHA/AFP via Getty Image
Dem don sentence former Democratic Republic of Congo President Joseph Kabila to death in absentia for war crimes and treason.
Di charges concern accusations say Kabila dey support M23, one rebel group wey don cause kasala across di kontri eastern region.
Kabila chop conviction on Friday for treason, crimes against humanity, and war crimes, including murder, sexual assault, torture and insurrection.
E reject di case as "illogical" and say authorities dey use di courts as "instrument of oppression". Nobody know wia e dey now.
Di 54-year-old rule DR Congo for 18 years, afta e take over from im papa Laurent Kabila, wey dem shood die for 2001.
Kabila hand over power to President Félix Tshisekedi for 2019, but dem later quarrel, wey make Kabila go into self-imposed exile in 2023.
In April dis year, di former president say e wan help find solution to di deadly fighting for di east and den enta di M23-held city of Goma di following month.
President Tshisekedi accuse Kabila say na im be di brain behind di M23 and senators comot im legal immunity, wey make di way for im prosecution.
Many years of fight-fight bin don increase earlier dis year wen di M23 seize control of large parts of di east natural resources full inside, including Goma, di city of Bukavu and two airports.
Pointing to overwhelming evidence, di UN and several Western kontris don accuse neighbouring Rwanda of backing di M23, and sending thousands of dia sojas into DR Congo.
But Kigali deny di charges, saying dem dey only act to stop di conflict make e no enta dia own kontri.
A ceasefire deal between di rebels and di govment dey agreed in July, but di bloodshed don kontinu.










