Top Judge for Sierra Leone enta gbege afta woman release videos to implicate am

Wia dis foto come from, The Judiciary of Sierra Leone
Chief Justice Sierra Leone, Justice Komba Kamanda don send Court of Appeal Judge, Justice Momoh-Jah Stevens on administrative leave wit immediate effect.
Dis immediate administrative leave dey come afta di Court of Appeal judge enta social media conversation for Sierra Leone ova one sexual allegation.
Howeva, Justice Momoh-Jah Stevens neva tok on dis mata as e dey gain social media attention.
Di allegation na from one young lady wey claim say she get belle for di Sierra Leone Court of Appeal Judge but e no wan collect am.
She accuse Justice Momoh-Jah Stevens for one social media video wia she allege say dem wan silence am ontop di matter.
According to Sierra Leone Chief Justice Kamanda, dat kain attention wey di mata don attract from different media and pipo fit put di judiciary for bad light.
Plenti Sierra Leone media dey tok about di video wey later get di attention of Sierra Leone Judiciary.
Justice Momoh Jah-Stevens na appeal court judge wey don head different cases on rape and oda sexual vices for Sierra Leone.
For December 2021, Justice Momoh-Jah Stevens bin preside ova cases for di Sexual Offences Model Court for Freetown wia e sentence one 18-year-old and 19-year-old boys to ten 10 years' imprisonment.
Dia offence na say dem 'sexually penetrate two girls wey dey below di age of 18' wey dey against Section 4 of di Sexual Offences (Amendment) Act 2019, Act NO. 8 of 2019.
September 2023 witness wia di Court of Appeal Judge Momoh-Jah Stevens bin describe di act of rape as 'degrading and naked act of aggression committed against woman.'
E tok dat one wen e bin dey preside ova one case of Conspiracy and Rape.
Also, for July 2023, preside ova cases for di General Civil Division of di High Court, wia e ask one media organisation and journalist for Sierra Leone to 'tender apology to di Inspector General of Police for defamatory broadcast.'
Justice Momoh-Jah Stevens dey popular for Sierra Leone judiciary system, and di current allegations against am don raise serious kwesions.
Why dem send Justice Momoh Jah-Stevens on leave
According to di Judiciary of Sierra Leone for dia statement, dem tok say di Appeal court judge gatz go on immediate leave sake of di different media publications wey surround am.
Sierra Leone Chief Justice, Justice Kamanda say di publication by different media against appeal court judge Momoh-Jah Stevens fit spoil di reputation of dia judiciary.
"Di attention of di Judiciary of Sierra Leone dey drawn to several media publications wey concern di Honourable Justice Mohamed Momoh Jah-Stevens, Justice of di Court of Appeal wey get di tendency to adversely affect di reputation of di Judiciary."
"E please di Honourable Chief Justice of di Republic of Sierra Leone to send di Judge on administrative leave effective immediately," di statement tok.
Di kwesion wey dey mind of pipo na wetin next for di appeal court wey dey di center of di big allegation wey dey spread for social media.
Sierra Leone Judiciary say dem go transfer di appeal court judge go di 'Judicial and Legal Service Commission (JLSC) for dia consideration.'
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post









