Dem don suspend di sale of Mandela ID card, shirts, walking stick, Bible, Quran, oda items

Nelson Mandela

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Items wey belong to Nelson Mandela, include some of im trademark shirts, wey go be on auction for New York if dem no block di sale
    • Author, By Gloria Aradi
    • Role, BBC News

One controversial auction to sell like 70 personal itens wey bin belong to South Africa former presido, Nelson Mandela don dey suspended.

Dem include one set of hearing aids, ID card, gifts from world leaders and some of di first democratic president clothing, such as im statement "Madiba" shirts.

New York auction house, Guernsey bin write for dia website say, Mandela, The Auction SUSPENDED, but dem no tok why.

Dis de come afta South Africa pipo bin hala against di sale.

South Africa goment dey try stop di controversial auction

South Africa goment dey try to stop controversial auction of 70 personal items wey belong to anti-apartheid hero Nelson Mandela.

Im eldest daughter, Makaziwe Mandela, dey auction di items in di US.

But di South African goment tok say di items belong to di nation.

Under di kontri law, items wey dem consider to be of national heritage dem no fit carry am comot for South Africa.

Di South African Heritage Resources Agency (Sahra), one goment body charged wit protecting di kontri history and culture, tok say dem don file appeal to block di sale.

Di kontri sport, arts and culture ministry don support di appeal. Minister Zizi Kodwa tok say dem dey back di case " for di sake of maintaining di kontri rich heritage".

Im add say di blocking of di sale dey necessary as Mandela "dey integral to South Africa heritage".

"E dey important say we preserve di legacy of former President Mandela and ensure say im life work experiences remain for di kontri for generations to come."

Di goment oppose di auction wen dem first announce am for 2021, as dem argue say some of di items wey dem wan sell na national artefacts.

As a result, dem bin cancel di initial auction wey dem plan for 2022 and fight legal battle for two years.

Last month, di High Court for Pretoria finally give Ms Mandela di go ahead make she sell di items, disputing di goment argument say na national heritage.

Mr Kodwa tok say make Sahra no proceed wit di auction and di culture ministry last month file request to appeal against di judgement, as dem cite "di unpermitted export for exhibition or sale" of di items.

Dem bin set di auction to start on 22 January.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

Why Mandela pikin dey try sell im papa tins?

Di items bin dey list of auctioned items by di New York-based Guernsey auction house. Dem tok say di hearing aids, for example go cost $20,000 (£16,000) and one shirt fit cost up to $70,000.

Ms Mandela neva respond to di goment latest opposition and oda members of di Mandela family or di Nelson Mandela Foundation no tok anytin.

She bin tok say di proceeds from di auction dey go towards building memorial garden in Mandela honour, near im burial site.

Di auction don cause storm for South Africa as some pipo dey tok say make di goment stop di sale of di "priceless" items.

But odas believe say make dem leave di issue to di discretion of Mandela family.

Mandela die for 2013 at di age of 95. Im lead di African National Congress in dia struggle against apartheid - system of legally enforcing racism - and im spend 27 years for prison.

Im become South Africa first democratically elected president for 1994.