Who be di judges for South Africa genocide case against Israel for di International Court of Justice?

Di International Court of Justice

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Israel chose British lawyer Malcolm Shaw to represent dem for di International Court of Justice

Fifteen judges for di International Court of Justice (ICJ) go consider South Africa case against Israel on charges say Israel commit genocide against Palestinian civilians during di war for Gaza.

According to ICJ rules, any kontri wey be party to a case and no get judge of dia nationality on di bench fit nominate a special judge.

Dis na di case for both Israel and South Africa.

Israel don select Aharon Barak, di former chief justice of di kontri Supreme Court, who don express support for Israel war against Gaza.

British lawyer Malcolm Shaw – wey dey considered to be one of di world foremost experts for international law - go also defend Israel for di ICJ.

South Africa Judge na Dikgang Moseneke. E be di former Supreme Court Deputy Chief Justice and e bin get ogbonge legal and academic career both for South Africa and abroad.

International law professor, John Dugard, go also represent South Africa for di ICJ case. E be former human rights rapporteur for di United Nations and don previously serve as judge for di ICJ.

Chief Justice Joan Donoghue

President of di International Court of Justice, Joan Donoghue

Wia dis foto come from, ICJ

Wetin we call dis foto, Dem elect Joan Donoghue President of di International Court of Justice for 2021

Joan Donoghue na US lawyer and legal scholar. She be di current president of di ICJ.

Dem first elect her to di Court for 2010 and dem re-elect her for 2014.

For 2021, fellow judges of di ICJ bin elect Chief Justice Donoghue to serve as di president.

She be di third woman to dey elected to di ICJ and di first American woman dem go elect as president.

Chief Justice Donoghue don serve as advisor to former US President Barack Obama and former Secretary of State Hillary Clinton and on all aspects of international law.

Vice President Kirill Gevorgyan

 Deputy President of di Court, Judge Kirill Gevorgyan

Wia dis foto come from, ICJ

Wetin we call dis foto, He dey elected to di International Court of Justice for 2015, and don be Vice-President of di Court since 2021

Dem elect Judge Gevorgyan as member of di ICJ in February 2015, and e becaome vice-president for February 2021.

E don hold di position of legal officer for Russia foreign affairs ministry since 2009.

E don represent Russia before di ICJ for several cases - most notably na one case wey Georgia bring ova Russia violations of di Convention on di Elimination of All Forms of Racial Discrimination for 2008.

Judge Abdulqawi Ahmed Yusuf

Judge Abdulqawi Ahmed Yusuf

Wia dis foto come from, ICJ

Wetin we call dis foto, E be former president of di court from 2018 to 2021

Judge Youssef na Somali national and e hold doctorate for political science and international law from di University of Geneva.

Dem first elect am to di ICJ for 2009 and dem re-elect am in between 2018 and 2021. He serve as a special judge for inside one case wey dem bring to di ICJ by Djibouti against France about mutual assistance for criminal cases.

Judge Julia Sebutinde

Judge Julia Sebutinde

Wia dis foto come from, ICJ

Wetin we call dis foto, She bin dey elected as member of di Court of Justice for di first time for 2012, and dem re-elect her for 2021

Born in Uganda for 1954, dem first elect Judge Sibutende as a member of di ICJ for 2012 and dem re-elect am for 2021.

She hold honorary doctorate for law from di University of Edinburgh for UK. She bin previously hold several judicial and legal positions, as she dey serve as judge for di Special Court for Sierra Leone from 2005 to 2011.

She don handle several war crimes trials, including di case against Liberian President Charles Taylor, wey chop accuse of committing war crimes and crimes against humanity during im presidency.

Judge Patrick Lipton Robinson

Judge Patrick Lipton Robinson

Wia dis foto come from, ICJ

Wetin we call dis foto, E be member of di International Court of Justice since 2015

Dem born Judge Robinson for Jamaica in 1944 and e don be member of di ICJ since 2015.

E work as legal advisor to Jamaica ministry of foreign affairs and for 26 years e be di kontri representative to di Sixth Legal Committee of di United Nations General Assembly.

E play leadership role on several provisions of di Committee, including di definition of aggression and di draft statute of di International Criminal Court.

Judge Peter Tomka

Judge Peter Tomka

Wia dis foto come from, ICJ

Wetin we call dis foto, Dem appoint Peter Tomka as Ambassador of Slovakia to di United Nations in 1994

Judge Ronnie Abraham

Judge Ronnie Abraham

Wia dis foto come from, ICJ

Wetin we call dis foto, E serve as former President of di International Court of Justice from 2015 to 2018

Judge Mohamed Bennouna

Judge Mohamed Bennouna

Wia dis foto come from, ICJ

Wetin we call dis foto, Bennouna bin serve as Permanent Representative of Morocco to di United Nations from 1998 to 2001

Judge Xue Hanqin

Judge Xue Hanqin

Wia dis foto come from, ICJ

Wetin we call dis foto, For 2018, dem appoint Xue as Vice-President of di International Court of Justice

Justice Dalveer Bhandari

Justice Dalveer Bhandari

Wia dis foto come from, ICJ

Wetin we call dis foto, Bhandari bin chair di Legal Services Committee of di Delhi High Court

Judge Yūji Iwasawa

Judge Yūji Iwasawa

Wia dis foto come from, ICJ

Wetin we call dis foto, E become member of di court for 2018, and e dey re-elected for 2021

Judge Nawaf Salam

Judge Nawaf Salam

Wia dis foto come from, ICJ

Wetin we call dis foto, Nawaf Salam bin serve as Lebanon ambassador and permanent representative to di United Nations from 2007 to 2017

Judge Hilary Charlesworth

Judge Hilary Charlesworth

Wia dis foto come from, ICJ

Wetin we call dis foto, She don be member of di court since 2021

Judge Georg Nolte

Judge Georg Nolte

Wia dis foto come from, ICJ

Wetin we call dis foto, For 2020, dem elect Georg Nolte as judge of di International Court of Justice

Judge Leonardo Nemer Caldeira Brant

Judge Leonardo Nemer Caldeira Brant

Wia dis foto come from, ICJ

Wetin we call dis foto, Hedey elected to di court for 2022