Prosecutors don add two more women to Sean Combs case

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Mark Savage
- Role, Music Correspondent
- Read am in 3 mins
Prosecutors for New York don expand dia case against rapper Sean "Diddy" Combs, dem accuse am of forcing two additional women into commercial sex acts, and swinging pesin ova apartment balcony.
Combs don dey jail since September afta initial indictment charge am wit racketeering, sex trafficking by force, and transportation to engage in prostitution.
On Thursday, dem update di indictment to add two more victims, although dem no add new charges to di case.
Di musician, 55, don firmly deny all di accusations against am, including di federal criminal case and more dan 30 separate civil lawsuits.
In response to di indictment, im lawyer, Marc Agnifilo, say di prosecution case "remain flawed.
"Di goment don add one theory say two of Mr Combs former girlfriends no be im girlfriends at all, but prostitutes. Mr Combs dey committed to fight and win dis charges for im trial."
Di original indictment identify only one victim, wey dey inside court documents as "Victim-1", di victim accusations tally closely to Cassandra Ventura - di singer wey sue Combs for rape and sex trafficking in 2023.
For di new filing, prosecutors allege say Combs "use force, threat of force, and coercion, to cause victims, three female of di victims but no be only dem" to engage in commercial sex acts.
Dem show di alleged violence for one video wia di musician dey kick, drag and throw vase at Ms Ventura for Los Angeles hotel in 2016.
Inside di new indictment, prosecutors claim say "Combs, wit di assistance of several close associates, pay hotel security staff $100,000" (£80,000) for di footage.
However, e leak to CNN last year. Combs later say im dey "disgusted" by di footage and im bin look for "professional help" afta di incident.
Ms Ventura say di violence she experience "break me down to someone wey I neva think I go become".
New claims
Di updated indictment signal say di federal prosecutors dey expand dia case against Combs as di date for im trial in May, dey near.
Footnote to di document notes show say dia investigation still dey go on and dem go file more updates "as soon as possible" ahead of di trial.
Among di new developments, prosecutors don move di alleged start date of Combs sex trafficking offences back to 2004, four years earlier dan dem tok.
Dem don also expand di list of narcotics di musician allegedly use to keep im victims "obedient and silent" - adding methamphetamine and psychedelic mushrooms to di list of cocaine, oxycodone and ketamine.
Di accusation say Combs swing one woman from balcony resemble claim among di civil lawsuit wey Bryana "Bana" Bongolan, fashion designer file for December.
Prosecutors also add claim say Comb no just assault women but also "im employees, witnesses to im abuse and odas".
Di musician legal team don previously dismiss di charges against am as "baseless" and accuse di goment of conducting "witch hunt."








