'You get bloggers but I get God' - Gospel singer Mercy Chinwo address her ex-manager inside emotional video

Foto of Mercy Chinwo

Wia dis foto come from, @mercychinwo Instagram

Read am in 5 mins

Nigerian Gospel singer Mercy Chinwo, don address di fight between her and her ex-manager Ezekiel Onyedikachi, wey pipo sabi as EeZee Tee, inside one emotional video.

Di two already dey court ontop mata of fraud.

For inside di emotional video wey last for about three minutes, Mercy allege say e bin bully and threaten her, she add say na becos of her safety she relocate from Lagos to Port Harcourt, Rivers state as e bin threaten to destroy her musical career.

"You tok say becos you make me who I be, you fit destroy me. You no be God, you no fit destroy me. You get bloggers, I get God. Di worst you fit do na wetin you dey do" Chinwo tok.

Chinwo also add say na Ee Zee Tee first sue her and not di oda way round.

"You seize my royalties for two years; you be bully. You be oppressor." She add.

Skip Instagram post, 1
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Instagram post, 1

Mercy allege say she bin sign management contract for 2017 with Eee Zee and e begin dey act funny becos she no sign di extension contract.

She tok say na Eee Zee carry her to court but claim say she dey oppress am.

"Di man claim say I sue am. Come online, make videos to tarnish my image. E look me and say, 'I make you who you be, and I fit destroy you.' I become scared of my life, and e get to one point wia I move from Lagos to Port Harcourt becos dis man make di environment toxic for me," she tok.

"E carry me go court come online to tok say na me carry am go court. You carry myself and minister JudiKay go court and you still dey claim to be di victim." She add.

Wetin EeZee Tee don tok about di mata

Meanwhile EeZee Tee for one Instagram post bin tok say im don go EFCC office and e no dey run from anyone.

E allege say one contract dey between am and Mercy Chinwo, wey she breach, and na why dem dey court.

EeZee Tee tok say im neva even see im capital from di transaction and wen im complain give EFCC, dem tell am say dem no get any contract.

E allege say evil pipo don gang up against am to destroy am and di system.

"Di gospel artiste wey suppose dey sing about Jesus and keep to her words and terms of agreement, put money for her personal account, no remit money but we dey remit money back to her until we send mail say we no go dey send royalty to you until we get financial reconciliations," e tok.

"Witout any form of religious influence of pipo wey get your interest. Na about justice, no be just about money, na about truth and integrity." E add.

Skip Instagram post, 2
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Instagram post, 2

How di matta start?

Foto of Ezekiel Onyedikachi and Mercy Chinwo

Wia dis foto come from, @eezeetee1/@mercychinwo Instagram

One statement by Pelumi Olajengbesi, wey be Mercy Chinwo legal representative, she allege say in 2024 afta one EFCC panel meeting between Mercy Chinwo and EeZee Tee, dem establish say EeZee Tee unlawfully divert $274,000 wey dem later collect from am.

E claim say na EeZee Tee carry Mercy Chinwo and EFCC go court wia dem establish say e don commit fraud and dem issue arrest warrant against am.

"For di EFCC investigation panel in 2024, wit all parties present and dia lawyers, dem establish say di sum of USD 274,000 dey unlawfully retained and diverted by Eezeetee from digital platform revenues review den," e tok.

Di statement allege say Eezeetee admit for EFCC office for di first time say two contracts bin dey, di original signed in 2017 and anoda wey e introduce two years after di actual contract don dey signed. E, however, beg say make dem settle di matter in peace. Forgiveness happun and dem reconcile.

Meanwhile, EeZee Tee claim say EFCC illegally extort $ 274,000 from am and detain am for nine days depsite say im dey share royalty wit Mercy Chinwo on a 50/50 ratio.

"Last year EFCC illegally detain me for nine days, far from Lagos. dem extort $274,000. I no drag you publicly. As a law abiding citrizen, I chose to follow legal process in di contract wey you sign wit EeZee Conceptz," e tok.

E challenge Mercy Chinwo make she post her bank statement from three years ago.

Who be Mercy Chinwo?

Mercy Chinwo

Wia dis foto come from, Mercy Chinwo/@Instagram

Mercy enta limelight for 2012 wen she bin win Nigeria Idol. Di singer journey into music no dey easy as she enta into di gospel music industry wit her hit single 'Excess Love' for 2018.

Mercy Chinwo, na 39-year-old woman from Rivers State, Nigeria. She start her journey as a musician for church as small pikin.

She sign contract wit EeZee Conceptz for 2017 and release "The Cross My Gaze (2018)" wit di record label.

In 2020 she record songs like Obinasom, Akamdinelu and Na You Dey Reign wey pipo dey enjoy local and internationally.

Mercy Chinwo don work wit oda gospel artistes like JJ Hairson, Nathaniel Bassey, Chioma Jesus, Banky W, Joe Praize, Samsong, Moses Bliss, among odas.

She marry Pastor Blessed of Water Brooks Church for 2022 and dem born one pikin togeda for 2023.