Ogbonge men of God for Nigeria, Ghana continue dia tradition of New Year prophecies and declarations

Collage of some ogbonge men of God for Nigeria and Ghana

Wia dis foto come from, RCCG HQ/Winners International/Prophetic Hill Church/Reign House Chapel

Wetin we call dis foto, Collage of some ogbonge men of God for Nigeria and Ghana
Read am in 5 mins

One tin wey some Christians for Africa dey look forward to during 'cross-over services' wey dey happun for churches on di 31st of December every year na prophecies and declarations from dia men of God.

Prophecies, giving of directions and prayers na part of di cross-over service to di new year for many churches for Nigeria, Ghana and oda parts of Africa for many years now.

Even though authorities over di years don warn make dis declarations dey done with caution, e never stop dem.

2025 no different. Dis na some of wetin some ogbonge and popular men of God tok about 2025.

Pastor Enoch Adeboye

Pastor Enoch Adeboye wear all-white wit microphone for hand during di 2024 cross-over service.

Wia dis foto come from, RCCG HQ

Wetin we call dis foto, Pastor Enoch Adeboye during di Cross-Over service for 2024

General Overseer, Redeemed Christian Church of God, RCCG, Pastor Enoch Adeboye wey pipo sabi as Daddy G.O hold im cross-over service for di Reedemption camp for Ogun state.

Di pastor say na Friday e go tok about prophecies.

"On Friday we go tok about di international prophecies we go dey careful not to tok about Nigeria much. Nigeria go pick dia own from di international prophecies.

Di year 2025 go be a landmark year, na year wey nobody go ever forget." E tok.

"Some earthly helpers will be replaced by heavenly ones.

Mockers go dey louder and more aggressive but unfortunately many no go survive di year.

Some towns and villages go shout victory at last." E add.

Bishop David Oyedepo

Bishop David Oyedepo wear all-white during di Cross-Over service for 2024 for Canaanland

Wia dis foto come from, Winners Chapel international X

Wetin we call dis foto, Bishop David Oyedepo during di Cross-Over service for 2024 for Canaanland

Bishop David Oyedepo of Living Faith Church also declare over im congregation.

"No prophet get di power to make wetin God tok to happun. Na di faith of di individual wey go determine weda e go happun or not." E tok.

E add say 2025 na "year of new beginning, new dawn, great chapters opening in your life. A new era.

2025 na your year of new era, new realms for all di areas of your life".

Pastor Daniel Olukoya

Pastor Daniel Olukoya wear all-white for di Cross-Over service for 2024 as e stand for pulpit wit microphone.

Wia dis foto come from, MFM International Headquarters

Wetin we call dis foto, Pastor Daniel Olukoya for di Cross-Over service for 2024

Dr Daniel Olukoya na di General Overseer of di popular Mountain of Fire and Miracle Ministries.

Olukoya during di church annual cross over service on Tuesday declare say "2025 my year of undeniable victory".

E also declare say "Year 2025 na a year of divine interruption, restoration of opportunities, unlimited deliverance, and di rise of Joseph, Esther, and Daniel and God go raise up transformative leaders.

Oda highlights of di declaration na say 2025:

"Na year wey prayerlessness dey extremely dangerous and year wey prayers dey needed to tackle strange economic and political turbulence (katakata)."

E say na year wey "we need prayer to tackle all massive weather turbulence (kasala) like floods and all kinds of disasters. We need prayers to tackle strange new infirmities (sickness)."

Jerry Eze

Di lead pastor of Streams of Joy Pastor Jerry Eze also focus on im congregation as e declare over dia lives.

"Di tins wey make you cry you go rejoice ova dem dis year. For di year 2025 you no go carry any evil load.

Somebody hear wetin God dey tok, I go give you speed wey go make you dey internationally visible. Creative ideas and solutions, revelations wey oda pipo no get dey rest on you right now." E tok.

"Dis year we go call am your year of daily miracles. Anywia wey you dey weak di lord dey give you strength.

Dis year, God go show you great mercy."

Prophet Nigel Gaisie

Prophet Nigel Gaisie

Wia dis foto come from, Prophetic Hill Church

Oga Nigel Gaisie from Ghana wey tok say political party pipo and oda goment supporters bin attack am sake of some of im prophesies for di last year, tok say make di new goment no do dat kind tin.

Im tok say make "di police no pursue men of God wey don dey do dia work for di spiritual realm."

Im prophesies and declaration for di year 2025 touch on several tins, from a new religion wey e say go take over Europe to weather/climate issues and political changes for some countries for Africa.

Rev Dr Isaac Owusu Bempah

Rev Dr ISaac Owusu Bempah na di founder of Glorious Word Power Ministries

Wia dis foto come from, Glorious Word Power Ministries

Wetin we call dis foto, Rev Dr ISaac Owusu Bempah na di founder of Glorious Word Power Ministries

Rev Dr ISaac Owusu Bempah na di founder of di Glorious Word Power Ministries.

E say, "dis tins wey God bin reveal to us, ordinary pesin neva fit understand; na spiritual tin, so make pipo take dis tins seriously."

Rev Owusu Bempah prophesies and declarations for 2025 also touch on political events, health, di economy and war.

Prophet Eric Boahen Uche

Prophet Eric Boahen Uche of di Reign House Chapel

Wia dis foto come from, Reign House Chapel

For di watchnight service for di Reign House chapel, Prophet Eric Boahen Uche also say "men of God go continue to prophesy wey be dia job, so make di police also do dia own job, but make dem no interfere for dia work."

Prophet Uche make some controversial prophesies about political and economic events for Nigeria and Ghana as well as some global events wey go lead to death.