‘I thank God say I no get stroke, di event fit don lead to death’ - Bishop T.D Jakes tok afta health emergency

bishop T.D Jakes

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Bishop T.D Jakes speak for di first time since im collapse during sunday sermon
Read am in 3 mins

American preacher and televangelist Bishop Thomas Dexter Jakes don speak for di first time since im get health emergency during Sunday service.

Di preacher bin dey preach on 24 November for im Potter’s House Church for Dallas, wen im suddenly begin to shake.

Di 67-year-old inside one viral video wey capture di incident no fit raise im hand during wetin di church and im family describe as “medical incident.”

Na so church leaders and oda pipo rush to di pulpit to support di Bishop and give am medical care as di rest of church don dey pray.

Since di incident, many pipo around di world don dey pray for Bishop T.D Jakes; im daughter wey be assistant pastor for di church togeda wit her husband bin update di world later dat evening say dia papa dey respond to treatment.

“But for baba God, tins fit be worse today as Bishop bin get medical incident. Bishop don dey recover under di care of medical sabi pipo.”

bishop TD Jakes

Wia dis foto come from, THE POTTER'S HOUSE OF DALLAS/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Di Bishop tok say tins fit don lead to death dat day if not for Baba God

Sarah Jakes Roberts add inside dat video say “we don dey try to make am sit down afta di attack, na im be di strong Bishop we know”.

Four days afta di incident, Bishop T.D Jakes don post one video on top im social media pages wia im dey thank di world for dia prayers during di emergency.

Inside di one minute video wey di Potter’s House also don post for dia social media page, Bishop bin sit inside wheelchair surrounded by doctors and tok say “I dey grateful to all di pipo wey pray give me, all di concern una show me, I dey grateful”.

Di Bishop wey bin dey emotional as im dey tok on di wheelchair add say, “I no dey afraid to die, I no wan hurt my pikins and di pipo wey love me, my church dem need me.”

Skip Facebook post
Allow Facebook content?

Dis article contain content wey Facebook provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Facebook cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Facebook post

Di oda few seconds of di video no dey audible but inside di caption of di post, im add say, “I give thanks unto di Lord say I no get stroke, however di event fit don claim my life if no be God wey intervene."

Bishop Jakes also bin thank di medical sabi pipo for “speed and expertise”.

"My job na to get beta and reflect on God protection," di ogbonge preacher tok.