G7 summit: Who dey attend and wetin to expect dis year

Wia dis foto come from, Suzanne Plunkett - WPA Pool / Getty Images
Di G7 summit dey host leaders of some of di world wealthiest kontris dis year for Canada to tok ogbonge issues.
Canada dey chair dis year G7 summit as leaders of Italy, US, France, Germany, UK and Japan go gada for Kananaskis, Alberta wia dia focus go touch around di global economy and security.
Di G7 (Group of Seven) na one organisation of di world seven largest so-called "advanced" economies wey dominate global trade and di international financial system.
Dis nations na Canada, France, Germany, Italy, Japan, UK and di United States.
China no be member, despite dia large economy and say dem be di second-largest population, even India no be part of dem but dem go attend di 2025 summit for Canada.
Also, di European Union (EU) no be member of G7, but dem dey attend di annual summit, including dis one for Canada.
Howeva, dis na di seventh time wey Canada dey hold di Presidency of di G7 and dis na Mark Carney first major international gathering as Canadian prime minister.
Ova di next 2 days, G7 leaders go do dia meeting to address global issues wey dey impact pipo around di world.
Some of di issues wey dem wan discuss include peace for Ukraine and oda areas of conflict around di world Canadian, and improving joint responses to wildfires.
Make we look some of di tins wey dey di G7 table:
Iran issue
Dis summit dey plan to strengthen peace and security, and di most recent na di Israel-Iran conflict.
Di Israel attacks on Iran, and Iran response, bin cause fear on global financial markets on Friday, 13 June 2025 as di price of oil bin go high, up to 7%.
Dis dey make pipo worry say we fit dey face anoda period wey di price of energy go rise, and dat automatically go make di price of evritin from petrol and food to go up.
Now, di Iran issue don suddenly find way to di top of di G7 agenda, and to agree on dis subject go dey tricky.
Global trade war
Di summit dey take place inside a global trade war wey Donald Trump bin start, as e dey use tariffs as a way to rebalance trading relationships.
Dis trade war na major concerns to several countries and trade relationship na priority for di G7 summit.
Dis summit dey also come as World Bank predict say di global economy go see di slowest decade for growth since di 1960s.
For 1 February 2025, US president fulfil im promise by implementing 25% tariffs on goods from Canada and Mexico, plus anoda 10% tax on China.
By 12 March 2025, di US begin 25% duty on all steel and aluminium wey dem import enta US and dis affect all of US trade partners including EU, wey react as e sama im own €26bn (£21.9bn, $28.3bn) worth of counter-measures.
Dem dey feel di effect of di US tariffs and e dey likely say conversation fit dey some how for dis G7 summit.
Forest fires, AI, critical minerals and Ukraine
One of di top priorities of dis year 2025 G7 summit na to improve joint responses to wildfires wey dey happun for different kontries.
A senior government official say, di summit go put in effort to improve di international joint response to di growing global forest fire threat.
Canada worst wildfire season on record na for 2023 and dis year, smoke from di fire blazes from some parts of North America and Europe na visible reminder to delegates for Kananaskis say wildfires na threat.
For di summit, building energy security and accelerating di digital transition wey go help mineral supply chains and using artificial intelligence to support economic growth, na part of wetin dey table to tok about.
Ukraine na anoda pressing topic on di agenda, wit President Volodomyr Zelensky hoping to discuss support for im kontri.
Also, dem go table issues around sanctions against Russia and future financing for reconstruction efforts for wia war don destroy.
Canada PM Carney bin also place countering foreign interference and interference for global diaspora communities as high priorities for di summit agenda.
Dis discussion go help set up potential ogbonge tok wit some of di leaders wey no be part of di G7, but dey attend di summit.

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images
Who dey invited to di G7 summit
As di host, Canada also invite leaders wey no dey permanently attached to di seven-member group, and PM Carney don give a number of di leaders invitation to attend-- though some dey more controversial dan odas.
All di G7 kontri presidents go dey in attendance for di summit, as well as some invited leaders.
President Volodymyr Zelensky of Ukraine go attend di summit, and go try meet wit Trump to receive reassurances of di US say military aid for Kyiv go kontinue.
Prime Minister Narendra Modi of India go also be a guest for di summit, wit Carney saying e get more important discussions wey India, as a major economic force, need to dey part of.
Mexico President, Claudia Sheinbaum, don also confam say she go dey for di G7 summit for Kananaskis and expect to sit down wit Trump for di first time.
Canada PM Carney also invite European and Nato leaders and well as dose from Australia, South Africa, South Korea, Indonesia, and Brazil.
President Lee Jae-Myung of South Korea go also dey in attendance as guest to get im kontri back on di world stage afta dia martial-law crisis.
President Cyril Ramaphosa of South Africa na di only African president wey dey di invitation list to attend di G7 summit. And e go try to get leaders on board for di G20 meeting wey South Africa go host later dis year.









