Kenya airport workers call off strike after two days of protest wey disturb flights

A queue of pipo wey dey wait to go through one door wey get di 'departure' sign above am. One man wey wear yellow tank top dey check tickets.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Jomo Kenyatta International Airport na a hub for flights to Europe, North America and di Middle East
    • Author, Basillioh Rukanga
    • Author, Wycliffe Muia
    • Reporting from, Nairobi
  • Read am in 4 mins

Flight operations for Kenya main airport don resume on Tuesday, on di second day of a strike by aviation workers wey cause cancellations, delays and diversions, and wey make hundreds of passengers dey stranded.

One statement from di The Ministry of Roads and Transport say dem reach agreement to end di strike after authorities meet with Kenya Aviation Workers Union (KAWU), di State Department of Labour, Kenya Airports Authority (KAA), and Kenya Civil Aviation Authority (KCAA).

Di industrial action by di Kenya Aviation Workers Union (KAWU) bin cause some disruptions to Kenyan airspace, particularly Jomo Kenyatta International Airport (JKIA).

Before dem call off di strike, Airlines bin dey ask travellers to check dia flight status before dem go Nairobi Jomo Kenyatta International Airport (JKIA) - one of Africa busiest transport hubs.

Before di strike end, Jack Okoth, one of di affected passengers, bin tell BBC say e spend more dan 20 hours for di airport, wey still dey crowded.

"We still dey here and we never get any concrete information on if we go travel soon," Okoth, one Kenyan student wey dey travel go UK tok.

Di strike come after a warning a week ago by di Kenya Aviation Workers Union (KAWU) of plan to go on strike over pay and poor working conditions.

KAWU Secretary General Moss Ndiema tell BBC Newsday programme say "dis no be go-slow strike but say na a full-blown industrial action".

E say one of di main reasons for di strike na "di failure by di Kenyan aviation authority to conclude one collective bargaining agreement on salary concerns and issues wey relate to working conditions".

Di strike bin affect all airlines, with no flights wey take off or land for JKIA, one flight booking agency bin tell BBC.

Flight tracking website Flightradar24 bin also show minimal air traffic for di airport.

Premier Airlines, wey dey operate direct flights to Juba, bin cancel im operations for a day.

Inside statement, Kenya Airways say e experience "air traffic control operational delays wey dey affect certain departures and arrivals". E add say e dey work with authorities to minimise disruptions and maintain safe operations.

"Passengers dey advised to expect possible schedule adjustments, including delays," di airline tok, as e apologise for di inconvenience.

One Kenyan senator wey bin wan travel from di western city of Kisumu say e bin get to travel by road sake of di strike.

"Passengers for JKIA dey currently experience di true meaning of patience and character development," anoda Kenyan tok, adding say: "If you get flight today just carry mattress because you fit sleep for di airport."

Kenya Airports Authority (KAA) say dem bin activate contingency plans for di airport and don ask passengers to contact dia airlines for updates.

Aviation sector workers blame Kenya Civil Aviation Authority (KCAA) of delaying salary negotiations, union mata and discrimination.

Dem also also accuse di authority management say dem no show willingness to settle labour disputes wey don dey ground for more dan a decade.

Last week, KCAA go court to seek orders to stop di strike. One labour court judge suspend di action pending further directions wey bin dey due next week.

Inside statement on Monday, KCAA say dem dey actively engage di relevant parties "in line with applicable labour laws and court directions".

E add say "in light of di planned strike" dem dey activate measures to ensure aviation safety and service stability.

Di main airport for Nairobi na one of di busiest hubs for di region and dey serve as a key gateway between di continent and the rest of wodirld. Last year, e handle about nine million passengers, according to Kenyan authorities.

Additional reporting by Kaleb Moges