Tourists and pilot die inside Kenya plane crash

Wia dis foto come from, Reuters
- Author, Basillioh Rukanga
- Reporting from, Nairobi
- Read am in 2 mins
One plane don crash near Kenya coast and kill 10 European tourists and one local pilot, officials tok.
Di aircraft bin dey fly from di popular beach resort of Diani to one airstrip for di world-famous Maasai Mara game park wen e go down at 05:30 local time (02:30 GMT), di Kenya Civil Aviation Authority (KCAA) tok.
Mombasa Air Safari say di plane bin dey carry eight Hungarians, two Germans and one Kenyan pilot - all of dem die inside di crash.
"Our primary focus right now na to provide all possible support to di families wey dey affected," dem add for one statement.
Local media don publish images of di plane in flames, wit debris scattered at di site of di crash.
Kwale County Commissioner Stephen Orinde tell di BBC say di plane bin crash about 10km (six miles) from Kwale town afta flying out of Diani.
E bin dey on im way to Kichwa Tembo, one airstrip for Maasai Mara, popular wit tourists becos of im wildlife.
"All di passengers na tourists," Orinde tok.
E say investigations into di cause of di crash dey go on but suggest say e fit be sake of bad weather.
"Di weather no dey veri good here at di moment. Since early in di morning, e dey rain and e dey veri misty, but we no fit pre-empt [di findings]," Orinde tok.
For August, one light aircraft wey belong to di medical charity Amref crash on di outskirts of di capital, Nairobi, and kill six pipo and injure two odas.









