Ghana Defence minister, Environment minister plus di six odas wey die for helicopter crash

defense and environment ministers

Wia dis foto come from, DR OMANE BOAMAH/MURTALA MOHAMMED/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, L - Dr Omane Boamah (Defence minister) R - DR Ibrahim Murtala Mohammed (Environment minister) bin dey on dia way to Obuasi to launch one govment programme.
Read am in 9 mins

Two govment ministers don die togeda wit six oda pipo for helicopter crash for Ghana.

Di chief of staff Julius Debrah confam di death for one press conference.

"I gat di unpleasant duty to announce dis national tragedy wey happun for our kontri dis morning. Govment regret to announce di death of di following pipo for dis crash.

  • Dr Edward Omane Boamah (Defence minister)
  • Dr Ibrahim Murtala Mohammed (Environment, science and technology minister)
  • Dr Muniru Mohammed Limuna (Acting Deputy National security coordinator)
  • Dr Samuel Sarpong (Vice chairman of NDC)
  • Samuel Aboagye (Former parliamentary candidate)
  • Squadron Leader Peter Bafemi Anala
  • Flying Officer Twum Ampadu
  • Sergeant Ernest Addo Mensah

"Di govment don extend dia condolence to di family of dis pipo wey don die in service to di kontri.

"All flags go fly at half mast until further notice," di Chief of staff announce.

file of military helicopter

Wia dis foto come from, GHANA AIR FORCE/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, FILE PHOTO: Di Ghana armed forces tok say three crew members and five passengers bin dey inside di helicopter

Di GAF helicopter Z9 wey dey go di Ashante region bin disappear from di radar, di Ghana Armed forces confam.

Inside one statement di Armed forces say "di GAF helicopter Z9 wey bin take off Wednesday morning at 9:12 AM from Accra bin dey go Obuasi don currently dey off radar."

"We dey do evritin to establish contact wit di helicopter at dis time."

Inside di statement Captain Veronica Adzo Arhin wey be tok-tok pesin for di Ghana armed forces tok say "na three crew and five passengers bin dey on board di helicopter as e don comot Accra."

For Obuasi for di Ashanti region, eye witnesses tok say one helicopter crash for di Adansi Amrofuom District, Wednesday morning.

Dem tok say di aircraft burn beyond recognition.

Who be Dr Omane Boamah

Dr Omane Boamah bifor im death na defence minister for di kontri from di New Juaben South Constituency for di Eastern Region.

Im be medical doctor, health policy and financial planning analyst.

E graduate as medical doctor from di University of Ghana medical school, also attend di Washington University school of medicine for St. Louis, Missouri for di US.

Im dey hold masters' degree for health policy planning and financing from. Di London school of Economics and di London school of hygiene and Tropical medicine.

During im school days, im be active for student politics wey im serve as di president of di National union of Ghana students (Nugs).

For im political career, Dr Omane Boamah between 2009 – 2012 serve as deputy minister for Environment, science and technology.

From 2012 – 2013, im serve as deputy minister for youth and sports under di late president John Evans Atta-Mills.

Ghana president for 2012 appoint am as im spokesperson at di time during im campaign.

Im also serve as communications minister for di first tenure of president John Mahama.

Who be Dr Ibrahim Murtala Mohammed

Di late environment minister bifor im death na Member of parliament for di Tamale central constituency for di Northern region.

Im be deputy information minister for di first tenure of president John Mahama 2013-2014.

Im also bin serve as deouty minister for trade and industry.

Dr Murtala Mohammed na trained teacher from di Tamale college of education.

Im get masters' degree for development planning and international relations and diplomacy from di Kwame Nkrumah university of science and technology

Im na muslim wia im dey married wit three children bifor im die.

For school, im serve as di general secretary of di all African students union for 1999 wia for 2009, dem bin appoint am as coordinator for di national youth employment programme.

Im first election to parliament happun for 2012 when di pipo of Nanton bin vote for him to represent dem.

Afta president Mahama bin win di 2024 elections, im appoint am again as minister for environment, science and technology.

Four of di eight victims

Wia dis foto come from, GHANA ARMED FORCES/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Govment don announce three days of national mourning for di crash victims

Who be Dr Samuel Sarpong

Dr Samuel Sarpong bifor im death na di first vice chairman of di govment party, di national democratic congress (NDC).

Im hold oda posts bifor di party elect am as vice chairman.

Bifor, na im be Ashanti regional minister.

Im also bin appointed as Central regional minister wey im also don contest as NDC parliamentary candidate for di Nhyiaeso constituency.

Im also bin serve before as di Kumasi mayor.

Na ogbonge politician for di country wey also bin attend Osei Tutu Boys school for di Ashanti region.

Afta im death, di school say, "we don sad for dis news of di death of Dr Samuel Sarpong (1977 year group), wey bin among di eight pipo wey die for di helicopter crash."

Di NDC inside one statement tok say "dis na devastating moment for our party and our nation. We don lose not only loyal comrades, but also exemplary patriots wey don serve Ghana wit honour, courage and dedication."

"Dis na irreplaceable loss to dia families, di NDC, di govment and di entire country."

Di party add say, "we go honour dia memory by upholding di values wey dem bin dey live by wey dem serve for - patriotism, selflessness, integrity and commitment to nation-building."

Dem born Dr Sarpong for Ejisu for di Ashanti region on 10 November 1957.

Im bin dey teach as sports teacher for di Juaben secondary school bifor im enta politics later for im life.

Who be Dr Muniru Mohammed Limuna

Oga Limuna na ogbonge politician wey im be former Northern regional minister.

Im also bin appointed before as former minister for agriculture under di first tenure of John Mahama as president.

Dem bin nominate am before as chief for di Damongo traditional area for 2024.

Di overlord or di Gonja kingdom Yagbonwura Bikunto Jewu Soale I.

Dem honour am during di 2024 Damba celebration for Damongo sake of im contributions to di region.

Alhaji Limuna na businessman wey also bin own one local radio station as im contribution to di socio-economic development of di pipo.

Dem born am on 8 August 1967 for Damongo Langbonto.

Im also serve before as Upper East regional minister from 2013-2014.

Until im death, na im be acting deputy national security coordinator for di new John Mahama govment.

Who be Samuel Aboagye

Oga Samuel Aboagye from di Obuasi East area for Ghana na former Parliament candidate for di govment NDC party.

Before im death, na im be deputy director general for di National disaster management organization (Nadmo) wey dey in charge of relief and protocol.

Afta di death, Nadmo release statement wey dem describe am as "dedicated pesin for di organization."

"Im service and unwavering commitment to di safety and well-being of Ghanaians go dey remembered forever, " Nadmo tok for dia statement.

During di 2024 elections, dem initially declare am as winner for di parliamentary election for di Obuasi east constituency.

But di electoral commission bin declare dat first results as void wey dem re-collate di results wey im lose to im opponent from di new patriotic party (NPP) Dr Boakye Yiadom.

Im first tok say im go contest di new results and challenge di vote for di Supreme Court, but later, im withdraw di court case.

Di three crew members

Wia dis foto come from, GHANA ARMED FORCES/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Di Ghana armed forces don receive di bodies of di eight victims for Accra

Who be Squadron leader Peter Bafemi Anala

Squadron leader Bafemi Anala before im die, na commissioned officer for di Ghana air force.

Im attend di Kwame Nkrumah university of science and technology (KNUST) for 2008 wey im student computer engineering.

"After im finish di undergraduate programme for 2012, im respond to di call to serve di country through di aviation and military leadership," one tribute from KNUST tok.

Im undergo flight and military training wia im become pilot for di Ghana air force.

For 2021, im bin return to KNUST to do master of science in air transport and aviation management.

At di time im die, dem don enroll am as post-graduate programme for safety and accident investigation for di United Kingdom.

All three crew on top di military helicopter bin dey wit di Takoradi air force base.

Western region Minister Joseph Nelson wey don visit di wife and family of di late squadron leader and di two odas tok say, "di whole country dey grieve but dis mata don hit us well well for di region."

Who be Flying officer Manaen Twum-Ampadu

Dem bin describe am as one of Ghana finest young pilots.

Im also base for di Takoradi air force base for di western region of di country.

E attend di Kwame Nkrumah university of science and technology - class of 2017.

Im graduate wit Geography degree afta which im decide to enta di armed forces.

Dem bin enlist am wey im undergo military aviation training.

Na im be among 12 new aviators wey dem bin present wit aviator wings (Air care badge) by di former President Nana Akuffo-Addo for 29 November 2024.

Im bin dey serve as flying officer wit di air force wen dem assign am to di Z-9 helicopter fleet to dey operate from di Takoradi air force base.

Di western region Minister Joseph Nelson don visit di wife of di late squadron leader - Lieutenant Ewuradwoa Kumi-Kyeremah wey also bin dey serve as psychologist for di 2nd Garrison western naval command for secondi.

"We don come to comfort di wife or flying officer Twum Ampadu one of our crew members during dis difficult time," di minister tok.

"Na struggle to find di right words but all we gat to say na God go give una strength," Oga Joseph Nelson tok.

Who be Sergeant Ernest Addo Mensah

Before im death, na im dey execute both tactical and logistics support mission for govment and military operations.

Na im dey in charge of safety procedure on top di helicopters.

Dem bin assign am to di Takoradi air force base, wia im bin dey work before di tragedy.

Sergeant Mensah bin dey serve on top di Z-9 helicopter as part of di air crew.

Im leave behind a young wife wey im marry only months ago.

Background of plane crashes

Di govment officials bin dey on trip to Obuasi to launch one govment programme di "responsible cooperative mining and skills development initiative" before di crash.

Ashanti regional minister Dr Frank Amoakohene wey finally attend di event sake of e dey hapun for im region, bin tell di crowd say im get to leave to attend to one emergency.

"If una no see me again for dis event, I bin dey rush to attend to one emergency wey don hapun, me and di commanders and di local authorities go comot di event to attend to dis emergency."

Di programme according to govment na part of measures to address di illegal mining kasala for di country wey don destroy waterbodies and forest reserves.

Sources within di govment tok say di president dey scheduled to attend dis event but im reportedly get oda commitments wey make am miss di event.

For June 2012, one Nigerian freight jet bin crash for Ghana wey kill at least 10 pipo.

Di cargo plane bin dey try to land for di airport for di Ghana capital before im crash into cars and wit passengers for di streets.

For 25 June 2020, one military aircraft bin crash-land for Ganvuliga for di Kumbungu district of di Northern region.

One statement from di Armed forces tok tok pesin at di time Oga Aggrey- Quashie tok say, "dem bin recover all four crew and four oda military personnel for di aircraft within minutes wit no fatalities and injuries."

For 19 March 2024, anoda military helicopter bin crash-land for one community for di Ahanta west municipal district of di western region.

For dat incident, 21 pipo bin dey inside di aircraft – assembly member for di area oga Thomas Dadzie at di time confam to local media network Connect FM say dem rush three pipo to hospital wey dem rescue three odas.