South Korea court reinstate impeached PM as acting president

Wia dis foto come from, Getty Images
One constitutional court for South Korea don dismiss di impeachment of Prime Minister Han Duck-soo, reinstate am as di kontri acting president.
Han take over as acting leader last December when dem suspend President Yoon Suk Yeol from im work and parliament impeach am afta e try declare martial law.
But Han neva pass two weeks for power before lawmakers vote to impeach am too. Since dat time, na deputy prime minister Choi Sang-mok dey lead South Korea.
South Korea don dey wit political wahala since Yoon try impose martial law but e no work.
Afta Han become acting president, e block di appointment of new judges for di constitutional court – somtin wey opposition bin hope say go make Yoon impeachment for sure.
Becos of dis, dem vote impeach Han.
But on Monday, di judges rule seven to one say di impeachment no go stand.
"I tank di constitutional court for di wise decision," Han tok afta dem announce di ruling. "I go work to bring di goment to order."
South Korea still dey wait fear for anoda decision wey di same court go make – dis time na about President Yoon impeachment.
Parliament impeach Yoon and suspend am on 14 December, but di impeachment go only permanent if di constitutional court approve am. If di court cancel am, e mean say Yoon go return to im work immediately.
Di court never fix date for Yoon verdict, but for di past weeks, Seoul don see plenty protests from Yoon supporters and opponents, as hundreds of thousands enter street for di capital last weekend.
One political analyst Leif-Eric Easley tok say di way di constitutional court take cancel Han impeachment show say dem wan look impartial, stand by di law, and bring peace during dis political wahala.
E tok say di decision "serve as warning to progressive parties say dia quick to impeach goment officials."
Dr Easley also tok say opposition lawmakers don file plenty impeachment motions, but di court don dismiss di nine cases wey dem don rule on so far.
"To reinstate Han na politics drama wey go set ways for di more important ruling on Yoon impeachment," Dr. Easley add.
"Di way di court dey side wit conservatives for Han case fit be strategy to create unity and make dem look legit" e tok.
Yoon court date neva dey set for di verdict, but for di past weeks, Seoul don see plenty protests from Yoon supporters and opponents, as hundreds of thousands of pipo enter di street for di capital last weekend.









