Who dey eligible for federal goment N25k monthly direct cash transfer and how to get am?

Wia dis foto come from, Bola Tinubu/BBC
Nigeria goment don list out conditions wey beneficiaries of di direct cash transfer programme dem dey plan to support fifteen millions households must fulfil as di cost of living dey rise.
As kontri pipo dey lament di high cost of food prices, President Bola Tinubu tok say im don make plans to restart di direct cash transfer to di poorest and most vulnerable Nigerians.
Before dem pause di social investment programme some months ago, three million Nigerians bin dey benefit from di programme but sake of di rising cost of living, goment announce say dem go increase di number of households wey dey benefit from di scheme to 15 million.
Di Minister of Finance and Coordinating Minister for di Economy Wale Edun, for one recent interview on Channels TV tok say di beneficiaries must get National Identity Number (NIN), Biometric Verification Number (BVN) plus access to mobile phone.
E say dis na to dey ensure say di moni reach di right pipo and make magomago no join di process.
Oga Edun say dem go give dis households N75,000 each for three months.
“Dat na N25,000 a month to 15 million households and each household go get about five pipo. So, dat effectively go provide funding for 75 million pipo.”
Apart from dis, di Minister of Finance also reveal say goment get plans to give artisans, youths, traders, women and Nano business owners non-repayable grant of 50,000 naira.
End of Di one wey oda users dey read well well
However, for dis case, digital verification go dey and e go cover at least 1000 pipo for all di 774 local goment areas of di kontri, dat na anoda N50bn to take help pipo during dis period.
Oga Edun say dis na di most direct way to help pipo at dis time.
State govnors begin tackle high cost of living

Wia dis foto come from, Getty Images
Meanwhile, some state goments don begin take actions to address di serious hunger plus di rising cost of living for dia various regions.
Dem take dis steps as Nigerians dey lament di high cost of food items across di kontri.
For some parts of di kontri, pipo don begin enta streets to protest di continuous rise in food prices for Africa biggest economy.
Recently, thousands of Nigerians enta streets for di northern states of Niger, Kano and Kogi and Oyo for western Nigeria, to demand urgent interventions wey go address di rising cost of living as dem claim say di situation don become unbearable.
Price of food items dey increase for dia fastest rate in nearly 30 years. Official record from di Nigeria National Bureau of Statistics (NBS) report say inflation dey at 29.9%, di highest in almost three decades, and food inflation tanda for 35.4%.
Many pipo all ova di world dey feel di heat of di high cost of living and pressure of inflation but di mata worse for Nigeria, sake of di fuel subsidy goment remove plus di persistent weakening of di naira, di kontri local currency, against major foreign currencies.
To address di situation, President Bola Tinubu bin meet wit di 36 govnors of di federation and charge dem to tackle di economy pressure dia citizens dey face.












