Pikin suppose get morale - tips on how to boost your pikin confidence

Dis father dey play wit im daughter

Wia dis foto come from, Getty Images

"Parent listen to you children, we are di leaders of tomorrow". Dis na one very common children song wey dem dey sing for Nigerian schools and na better way to send message give parents.

As pipo dey celebrate Children's day wey be May 27 evri year, e dey important make parent know how dem fit boost di confidence of dia pikin.

Nigeria President Bola Tinubu for im 2024 Children's day message say children na di "bearers of our nations torch into di future".

"I reassure di nation of my commitment to ensure a safe and secure ambience of learning for di children while improving di standard of education, Tinubu tok.

However, some parents still neva know say some of dia actions dey affect dia pikin and dis dey lead to low self-esteem.

One ogbonge child development sabi pesin Raquel Kasham Daniel follow BBC Pidgin tok on how parents fit boost dia pikin confidence.

She highlight di various ways wey students dey take get low self-esteem and how parents fit help.

“If we dey sincere, even di unrealistic standard by di media dey cause low self-esteem becos now, a lot of children dey take wetin dem see for media - even from wetin celebrities and pipo dem dey look up to dey showcase.”

How pikin dey get low self-esteem and how to spot am

According to Raquel, low self-esteem for children dey caused by different tins wey include:

Negative experiences- Some children don get experiences wey make dem fear and some even cause dem pain. Dis negative experiences dey give di pikin low self-esteem.

Overly protective parenting - Some parents go think say dem dey help dia pikin wen dey camp dem without freedom to explore. Some of di parents also get overly protective for dia pikin and e dey affect dem

Trouble wit friends- If pikin get trouble or fight wit dia friends outside, e dey always make dem silent or not to follow pesin tok. Dis dey lead to low self-esteem wey get series effect on di child.

Academic pressure- Truly, plenti parents want make dia children do well for school and to also get high marks for dia academic. However, some parents dey also put pressure ontop dia pikin, e dey even come wit beating too and dis no dey help di children.

Raquel wey be di founder of ‘Beyond The Classroom’ tok on how parents fit spot low self-esteem for dia pikin.

“Parents fit spot low self-esteem if dia pikin dey avoid challenges; pikin tok negatively about demsef; pikin dey withdraw from social activities, if pikin dey complain alot, if dem dey withdraw from activities say dem wan stay on dia own.”

Raquel Kasham Daniel na child development ogbonge pesin

Wia dis foto come from, Raquel Kasham Daniel

How to boost children confidence

Some of di ways wey parents fit build dia children confidence include:

Offer praises - Make parent dey make efforts to praise dia children wen dem do tins regardless of how small it is. Make parents set achievable goals for dem- lay bed, read books and wen dem do am, make parents praise dem.

Positive affirmations - If parents fit learn how to use positive affirmations for dia pikin, e go help boost dia confidence. Instead of blaming and cursing di children, make parent use good words on dia children- e go help dem to feel loved.

Create supportive environment - One of di ways parents fit boost children confidence na to support dia pikin. Parent gatz create an environment wey dey open and free from judgement, many times children no fit tok to dia parents and e dey cause low self-esteem.

For one of her book for children, Raquel tok on truth, honesty, and trust for children. She believe say children gatz develop di “courage to always tell di truth, even wen e dey hard, and di realization say di truth can set us free.”

She add say honesty na powerful virtue for children wey fit guide dem through situations.

Oda tips wey fit help your pikin

Boy throw ball for up wit im papa

Wia dis foto come from, Getty Images

Break advice down and adjust am for your pikin - Nobody fit know your pikin like you, so you go need to help am dey breakdown advice for dem to understand wetin e mean and how e fit help dem.

Know your pikin special interests and likes - Different pikin dey get different special interests and likes wey dey help dey relax and also connect wit dia friends. Dem dey always learn from wetin catch dia interests and e go dood make parents know wetin dem dey interested in.

Wen parents know wetin dia pikin like, dem go fit engage dem well well and e go be great joy to di children wen dem get love from dia parents.

Get predictable routines and daily patterns

For di children wey still dey learn wit materials, e go good make parents sabi how dem fit dye use objects teach dia pikin on a daily routines so dem go get used to am. Children can learn from continuous daily routines- di more dey make crafts, dey understand it more.

Understand your pikin language and communication

Children learn in various ways and if parent understand how dia pikin dey communicate, e go help dem more. Some children go dey silent wen dem dey danger or wen dia heart dey troubled. Wen parent understand dis, dem go fit communicate better. Some children prefer soft voice wen dem dey correct dem, if parent use harsh voice, dem fit no get confidence again.