Bobrisky don come out from prison? wetin we know

Wia dis foto come from, EFCC/X
Nigerians for social media don dey congratulate celebrity and influencer Okuneye Idris wey dey popular as Bobrisky as local media dey report say say she don comot for prison.
For one post for social media wey one designer post, she say "finally out, Bobrisky fine die". She make di post wit one video wey show as Bobrisky and two oda pipo dey inside car.
For anoda similar video wey show as Bobrisky dey grant interview, im advise pipo to "follow di rules o, no spray money o, unless you go be landlord inside kirikiri like me o!
"Trust me, no be all about stealing or killing, somtin wey dey as small as dis [spraying money] fit carry you go prison." im tok.
Di Nigerian crossdresser add say im dey focus on im good energy for her fans and pipo wey bin dey for am.
Authorities neva confam if Bobrisky don come out from prison or not but di six months jail term begin count from 24 March, 2024 di day dem first put am for detention.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
Wetin bin happun
For April 2024, court bin sentence ogbonge Nigeria celebrity Idris Olanrewaju Okuneye wey pipo sabi as Bobrisky to prison.
Justice Abimbola Awogboro deliver di six-month sentence to ‘Bobrisky’, wey bin dey detention since dem first arrest am.
Di court pass di sentence wit no option of fine. Di Crossdresser bin dey for di Ikoyi correctional centre.
Na Federal High Court for Lagos sentence di crossdresser.
As pipo bin dey ask which kain prison im go come dey, di judge bin refer to am as 'he' for court.
Wetin dem charge am for?
According to di charges wey EFCC sama Bobrisky, dem say im tamper wit di sum of 400,000 naira wey im spray while im bin dey dance for one social event wey happun for Lekki area of Lagos on 24 March 2024.
Di prosecutor Rotimi Oyedepo (SAN), wit seven oda lawyers also charge Bobrisky sake of say im tamper wit di sum of 50,000 naira wey im spray for Ikorodu between July and August 2023 wen im dey dance for one social event.
EFCC also accuse Bobrisky of spraying 20,000 naira for one event for Ikeja while dancing for December 2023 and anoda 20,000 naira for Victoria Island area of Lagos.
Court bin convict Bobrisky afta im plead guilty to naira abuse.
Na Justice Abimbola Awogboro of di Federal High Court for Ikoyi convict di crossdresser.
EFCC bin carry Bobrisky go court ova case of money laundering and spraying of naira notes.
Bobrisky bin appear for court to face six count charges wey surround money laundering and di abuse of di naira plenti times.
Wen dem read di charges, Bobrisky plead guilty to di first four counts bordering on naira abuse.
For di number five and six count charges, EFCC say Bobrisky commit offence wey dey contrary to Section 6(1)(a), and Section 19(1) (f) of di Money Laundering (Prevention And Prohibition) Act and punishable under Section 19 (2) (b) of di same Act.
EFCC say Bobrisky get one company wey dem pay about 127.7 million naira inside and im no submit di activities to di Special Control Unit Against Money Laundering between September 2021 and April 2024.
For di last count charges wey EFCC sama am, Bobrisky no submit di declaration of di activities of im company wen anoda 53 million naira enta im account again.
However, for court, di EFCC say dem don follow Bobrisky tok and im don cooperate on how dem go sort dat part.
Di EFCC strike counts four out of di six.
Dem say Bobrisky dey trade but im no submit a declaration of di activities of im company.
Which cell im bin dey
According to authorities, na di prison wey suit im biological gender dem bin keep am as di court and even di EFCC refer to am as 'he'- a male gender.
According to di Central bank act 2007 (section 21), na offence to dey spray money or match di money wey di central bank print.)
Di act recommend a punishment of six months, option of fine or both.
Meanwhile, lawyer to Bobrisky Ayo Olumofin bin first tok say im client na first offender and make dem treat am like dat.
Di judge rule say Bobrisky jail term start on 24 March, wey be di day wey dem first arrest am.









